One church for naija dey do singles convention. Di pastor raise - TopicsExpress



          

One church for naija dey do singles convention. Di pastor raise prayer point sey all di singles should pray for dia hearts desires. Na im wan sista begin pray “oh lord, I no wan marry short man, Holy Ghost , I no wan marry short man, Angel Gabriel if you take eye see short man wey dey come my side use holy ghost fire bind am” E come be say one short man dey beside di sista dey pray im own sey ” oh lord, you know sey I be short man but I be billionaire”. Immediately di sista hear the word ‘billionair’ prayer com change. She begin pray say “oh lord! Na your voice be dat? how I go com say no, lie lie. I go marry di content and ignore di container”
Posted on: Fri, 22 Aug 2014 02:00:02 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015