One day twenty naira note and one thousand naira note dey gist , - TopicsExpress



          

One day twenty naira note and one thousand naira note dey gist , na im twenty naira say, “Hey, where you don go, wetin you dey see? I never take eye see you for dis side before”. Di one thousand naira answer am, dey blow fone, “I have been hanging out at the casinos, went on a cruise and did the rounds of the ship, I hang out often at the National Assembly in Abuja, or VI in Lagos, clubs, restaurants, mansions etc. so many places, how about you?” The twenty naira note , look up, look down, shake head and said, “My life na di same routine, you know … church, church, church.” Na so so church dem dey carry me go, leave me dia and when I get luck comot for church di next person wey get me na church e go return me too. Hey, see my life!
Posted on: Mon, 28 Jul 2014 10:35:53 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015