Only Nigerians can have full conversations with just - TopicsExpress



          

Only Nigerians can have full conversations with just QUESTIONS. Dele: My guy, How far? Emeka: Wetin dey happen? Dele: Why you jus dey call me now? Emeka: You buy me credit? Dele: Dis wan wey you call so, you wan show? Emeka: Where u dey? Dele: You sabi Plus place? Emeka: Make we block there? Dele: Before nko? Abi u wan make we block for anoda place? Emeka: You get pay? Dele: Wetin you wan take money do? Emeka: We no suppose to drink? Dele: Na me born you? Emeka: No be u be my chairman? Dele: Abi craze don log on to u? Na my pay u go dey use maintain? Emeka: Before nko? Dele: U serious abi you dey play? Emeka: Bros, wetin u tink? Dele: So, u no really hold change eh? And u wan drink? U no dey shame? Emeka: Bros, which ones na? Na change for beer come dey cause dis kind yarn? Dele: Before nko?
Posted on: Thu, 22 Aug 2013 08:14:47 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015