Open Letter to President GEJ on ASUU Strike frm warri Oga - TopicsExpress



          

Open Letter to President GEJ on ASUU Strike frm warri Oga Presido, First of all I hail ooo! I no say u no dey cary last. You be confirm warri pikin. But ur middle name Ebele means mercy nd make u pity ur children settle their lecturers naa! D matter neva tire u? Suppose say ur pikin follow us dey house, Sheeh you for neva answer our lecturers dem? Una say make we bone kidnapping, militant nd all bad bad things, say mak we go enter school, now na una com dey f**k up. Al d things wey dem lecturers don teash us for klass we don forget am finish. Last last, na una go still call us “half-baked”, “half-roasted”, abi na “half-fried” Dem talk say person no fit run pass him shadow. We go dey lasgidi dey for you. Na ur time be dis use am well, but we go catch you for 2015. U don forget say youths na we dey vote pass. Na we too dey snatch ballot box, dey do rally and som kain kukere things wey dem dey take win election. U go still nid our help. Dat time too we go go strike. Shebi u sabi waka for bare feet, u go carry ur leg do ur rally. No thugs for u. We no go snatch ballot make you for win. If any maga try am we go fall am. So Oga Jona, na ur opportunity be dis ooo. Make u code this stubborn ASUU make dem cary their wahala go back. We no say na rush them go rush us wen dem com bac but we no send. So make u do something because our mate dem for private university don graj finish. We don tire to dey beef them. If u no shake bodi fast make u no forget say university of militancy still dey admit. Dey neva release 2nd batch ooo! Help us grit maale Patience. We go stop for here.
Posted on: Tue, 08 Oct 2013 21:52:51 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015