Oyibo people think say them get things wey we no get, but me Akpos - TopicsExpress



          

Oyibo people think say them get things wey we no get, but me Akpos say na lie, Everything dem get, we get am too. Dem get T-pain, we get Timaya. Dem get T.I, we get M.I. Dem get aircraft, we get witchcraft. Dem get 2pac, we get 2face. Dem get Beyonce, we get waje. Dem get Lil wayne, we get Terry G. Dem get TIMBERLAND, we get DON JAZZY. Dem get wiz khalifa, we get wizkid Dem get Hollywood, we get Nollywood. Dem get silicon valley, we get computer village. Dem get miami beach, we get lekki beach. Dem get Al paccino, we get pate Edochie. Dem get pirates of the carribean, we get pirates of Aba. Dem get beauty and the beast, we get bianca and ojukwu. Dem get Mr. Bean, we get Mr. Ibu. Dem get American lotto, we get Baba Ijebu. They fear Al Qaeda, we fear Boko Haram. abeg add more lets show them that everything them get we get am too
Posted on: Wed, 12 Nov 2014 16:00:03 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015