P.m News/Updates. 06/06/2014. Report use Water Melon take - TopicsExpress



          

P.m News/Updates. 06/06/2014. Report use Water Melon take enter studio say the Emir of Kano, Ado Bayero don kick bucket today. The Hausa Monarch kpuff in the early hours of today. Alhaji Dr. Ado Abdullahi Bayero (CFR, LLD, JP) na former Ambassador to Senegal and he don hold the position of Emir since 1963. Na him be the longest serving Emir for d history of Nigeria Emirship. May Allah grant am rest. Report use Tagerin take enta studio say, Echiagu wey be king of Cow wey dey stay Anigboro Street. Warn dat ur son, becos he don dey use ur gun take dey chase pipo all in d name of play. He don too dey constitute nussaince for d street with dat he behaviour. Also, we don dey notice d movement of new, new small boys wey don dey gada d street as d tin don dey show us sign of Cultism. Our alert don reach Army hand and we don submit names to dem. Unu go soon hear from us for dat area. Echiagu pikin, get sense now. Report use Paw-paw take enta studio say dat Madam wey dey sell Salad and Fried Rice ingredients for Ajogodo Rd by Otite Junction, dat ur son wey dey kolo don dey too dey ova harrass pipo. Make u try caution am or beta still, make u go admit am for Uselu before he go use plank take faint person one day. U fit still go Uselu go buy Olazinpine for am to dey drink so dat he kolo go disapear. Report use Mango take enta studio say Chachangi wen get Car Wash opposite Youth Centre for Awolowo Road nai dem do he Papa Burial for Oria Abraka today. The village boys dey form say dem dey hold rain & dem dey make am worse wit deir witch craft till dem come give dem wetin dem want. Dem dey look face dey share drinks.The place full like convention but I nor taste anything. The burial dey successful sha and we all cum back safely. Report use Guava take enta studio say Today na the year middle day. We just complete 183 days and we go still get 183 days. So from studio we dey wish all unu A happy half year, hope say we go see all ourselves for d end of the remaining 183 days. Oya make unu begin wish unuselves for d studio happy half year. Report use Sherry take enta studio say Ethiope Primary School wen dey Ofotokun Rd dey lack teachers. Wen our man around town visit dem, he con see say one teacher dey control class of 40 to 50 pupils, even one teacher dey teach two classes, while some school like Oton, Crowther, Abeke e.t.c, get 2-3 teachers for one class. Abeg make Govt try add more teachers to Ethiope. .Teachers nid to b up to 2 for class so dem fit divide d subject dey teach and e go make d teaching effective and easy to control d pupils. D Children nai b d future of our dear country. Counter report use Apple take show say d Jakpa Senior Wife (Helen) wen pipo dey claim say nai be senior wife, say she force and manipulate her bride prize to be paid for 2008 when Late Jakpa don already dey on wheelchair, d intel say she dey proud to announce dis info and challenge anybody to contest dis claim, and wit dis fact, d pix of John and Alice Jakpa wedding for 1966 nai dey attached to dis post. See gbege for studio with counter fact. Report use Otiti take enta studio say dem do one burial for Itsekiri Rd today and na one woman nai drop. Wen i sidon dey wait to cry make dem for give us food nai Pastor Gbemisoke burst out. The service dey o.k but d interpreter dey very loud and i tire for d guy. Food and drinks nor too plenty but the children try. Report use Pinapple with Pea take enta studio say make we wish the widow of Late Hon. Charles Okiti wey dem dey call Mrs Bee Okiti Oghogho Happy Birthday today. We use d fry pan of Long Life take fry ur egg of Prosperity for u today. Favour, Joy, Breakthrough, Divine Protection and Goodluck nai we take do key holder for u today as we sponge ur body with Goodhealth. Oya begin to dey dance. SAY NO TO CULTISM #PrayForKefee God Bless Sapele SAPELE/DELTA STATE MUST BETTER.
Posted on: Fri, 06 Jun 2014 20:32:15 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015