P.m News/Updates. 06/11/2014. We dey by dis update dey - TopicsExpress



          

P.m News/Updates. 06/11/2014. We dey by dis update dey inform all our Sapele students of Delta State Polytechnic, Ogwashi-Uku say, resumption for 2014/2015 academic session na on the 10th of November, 2014. Dem say make I tell unu also say na yesterday dem authorise all HODs to publish unu results and registration don already start. I welcome unu to a new academic session. Make unu face unu studies and say no to cultism. Report enter studio say na today nai dem do the SERVICE OF SONGS of Mr Benjamin Obiunu for 27 Esidje Street for Urhuakpa area. We throway congratulations give the children and family members of our late Daddy for d successful prayers and we encourage unu to do same for the burial tomorrow. I go dey dere well and also make unu nor forget my cooler of food or else kasala go burst. On behalf of the Girl wey we appeal N40K for due to her poor financial background. We say big thank you to all unu wey make sure say dis Girl go back to School. As at dis morning,she don get alert wey clock N40k. We congratulate unu for unu support and we pray make God provide for unu. Also we pray make God bless unu wey get d intention to give but due to somethings unu nor fit contribute now. Make unu nor worry God go bless unu to helep others. And for you wen dey helep. Make sure say u nor carry our money go give Boy and make u study hard so that u go join give tomorrow after u secure better job. Despite d death of Black Angel, Mega plannet nor fit shut down for even few hours to mourn d boy. Report reach us say as d news of Ema death reach Sapele, Mega Planet still do groove yestader. Which means d boy death nor pain dem. Make unu try do sometin to mourn d boy bicos na there e dey join dey mc for unu. Pay last respect to d boy Mega Planet becos d boy Ghost dey gwan for our studio here say unu nor try. Report enter studio say Ufuoma Secondary School nor be School for Civilians again. Today nai oje yeye Aunty wey dey teach Cultural Creative Art JSS2,enter the class start to pull d student uniforms. She use her corocoro eyes go burn d Uniforms bcos dem nor get badge,d student come use ordinary body take go house. Hon. Ejaife Odebala dis na ur first task, make u see watin person dey do other person children. Dis Aunty don buy market. Ahead of the celebrity wedding of Blessing Okagbare and Ighoteguonor Otekeri wey go take place dis weekend for Sapele, dignitaries don dey enta d town. Almost all d hotels for Sapele don full. Our Snap Shot HVD Camera capture Onajite Malcolm Tagbarha for d town as he don show face for d wedding. Many whity don full d town as different flashy cars don dey show face. We dey call on Nigeria Army, Navy, Airforce, Police, forest guard and local vigilantee to beef up security dis period becos dis weekend go mirror Sapele to d world. Chairs and Tables don lie down for Sapele Athletic Club. Them don dey erect the Tent also. Make unu set my seat well. Our CCTV Camera capture Kefe Illaya dis evening around 7.pm for he sister butik wey dey along New Rd as he dey drink beer with one babe. Naso Kefe juss dey do face like oyibo rabbit as he dey speak one kain gramma wey nor dey dictionary. Naso he juss dey smile mue mue becos of d babe wey sitdown near am. Lolx Make EBERE Egede stop that rubbish wey she dey do! She dey wear clothes from her store take dey snap pictures dey form like say na her own dey put for bbm dp,take dey contest Edna Okorodudu and Osherma Olololo etc. That one nor pain me reach her friends wey she dey allow dey wear too. Dem dey wear am commot too but them nor dey cut d label. One of her friend wey be Ebere friend help her cut label that on Sunday wen dem dey comot,nor be small thing she use d girl eye see ! She begin hala..I send you make u cut am for me? Which kain wahala be dis now? EBERE go say make I pay o!! How she wan take sell am now. D top na three k according to her. God forbid bad thing. Ebere Angelo Egede change. FRAUD ALERT!!! A guy wey dey call himself Engineer Stephen dey scam pipo with this number: 07035545984. He go call people like say he know u,for some pipo case e dey call their real name sef. Then he go say he call as regards that job wey he tell u of for Seplat or Chevron any one wey e enter him mouth. Make unu save d number for unu fone with fraud. Then if you play along he go send one G. T bank account number to you to pay in twenty k for your form and swimming lesson. Who know dis boy Atika Mudiaga Efemorhene. Make unu tell am say we get urgent message for am and make he visit our inbox with immidiate effect. Report enter studio say Late Emma a.k.a Black Angel waka enter e own waterloo due to haters,wey strike deal with am but along the line we nor know,wetin happen. But we hear say na invitation e get to Ughelli,and na for dere dem for stab am to cold death. We join all Safarians to wish Black Angel farewel and we pray make God helep us reply the people wey do dis evil act against our handsome son. Na him picture dey under dis post with dread for e head. Drop your condolence under. God Bless Sapele. ADIEU BLACK ANGEL!!! SAPELE/DELTA STATE MUST BETTER.
Posted on: Thu, 06 Nov 2014 19:28:23 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015