P.m News/Updates. 23/09/2014. Report reach us from Abuja say - TopicsExpress



          

P.m News/Updates. 23/09/2014. Report reach us from Abuja say our Federal Military Team don announce the death of the most dreaded Shekau the head of Boko Haram last weekend. The issue now be say the Intelligence of Cameroon Soldiers and Nigeria Military team dey claim say na dem nai kpai the head of Boko Haram. As a matter of fact we norva fit acertain weda na d real Shekau nai dem kill or not. We go keep unu posted for more details. Report jump enta studio now say Sapele Waste Management Board with the help of Hon. Julius Egbedi don dey evacuate all d dirty wey dey along New Rd and oda strategic places wey dey cos offensive odour for the town. We dey use dis update dey inform Oga Egbedi say make he nor look d dumping site wey dey near Victory Centre Church throway face and report don still land our studio say dirty don dey dance Igbe along Mission Road by Gana Health Centre,also Nana Road,and back of Ethiope School for yoruba road side. Dis dirty dem nor gud for human health. Report enter studio some group of persons from Sapele and most especially WARD1 don sidon for Abuja dey file report against Hon. Monday Igbuya due to say Hon. Monday Igbuya nor dey do well for deir eyes. When we use our Microscopic lens view Abuja visitors for our Ghost Data base nai we see say na Sunday Nwankegho nai lead d team. I dey use dis update dey call on all agrieve persons to cum my inbox make only we for Sapele settle our issues,as i nor want make we lost or fight ourselves go outside the town. Report reach me for studio say Efe Mafuru wey be the two times Councillor of WARD1 don single handedly take WARD1 as e personer property and wit dat,e don dey prepare to contest Councillor position again for the 3rd time. Efe Mafuru i know say you dey try but u dey among d worst Councillor wey Sapele don ever produce. Report jump enta studio say one of EJIRO ONOVUGHE Motor wey dey run Lagos don kaput along Benin/Lagos Road. The motor registration number na XB-505-GRA. All the pasenger just tire as some dey cry say Ejiro don dey do dem like dis for some time now. Oga Ejiro, e good make u upgrade o. Even dis ur motor wey kaput so nor get brake. As we dey update so, dem don work on themotor. All d passengers get lucky say d motor nor jam. Some pasengers wan even kpons the driver but he come dey explain say na the Management nai suppose put the motor in order say him na odinari driver, say make d passengers nor vex. Ejiro, atink u don dey find blood dis Ember period to renew ur.......? Report fly enta studio say nor be small dancing and celebration for Eris Education Centre today. D proprietress dey happy dey dance for rain becos say d school record the best primary six result for Delta state! All merit and distinction. No pass no fail. Pipo go dey say the school too like swag say dem nor dey teach but with dis now God don close their mouth. Eris, dat nor be yard stick sha, I still dey roast unu gbwa for Mama Oghale hot fire. Report jump fence enter studio say e get one man wey dey rent building materia for Shell Road before immigration office, dis man con rent wheelbiro and shovel give one boy wey dem dey call Justice. Thief con thief d tool for where Justice dey keep am after work, d man wey get d tools con say make Justice pay 4 d tools, so Justice con agree to pay, but e never get money, nai d man con take police arrest Justice, then Justice con tell d police say dem b 9 of dem wey take d tools take work, d police con invite all of dem come Police Station. These boys age na between 12; 13; 14; and 16yrs, nai Sgt Edet carry the 4 of dem lock inside cell yesterday, when d owner of d tools come Police Station dis morning, e con tell Sgt Edet say e won go settle with d parent of d boys say make e bail dem, wen dem con ask d Sgt how much 4 d bail, e con say na 10k for for one child, nai d parent of d children provoke, but d yeye Sgt Edet still dey say na 10k last, l never c where small pikin 4 lost person tin and e agree to pay dem go say make dem bail am with 10k, after much beg and shout, e con agree to collet 5k, dis injustice wey dis Sgt Edet do to dis small boys so, E good Safarians becos if i talk dem go say na my own worst pass? Report enter studio say Hon Lazarus perform yesterday as, our studio dey warn you say dat rubbish wen u do yesterday night around 8pm, wey u rough handle dat man with jeep 4 Weco Junction by Total & nor b say d man do u anything bad so, na Almighty God nai go pay u back. But d LUCK u get b say ARMY normeet u there,when dem cum & d man nor know where u dey stay if not u forsmell ur coat. I dey use dis update dey warn u to stop dis ur oppression if u wan live long. Report reach us for studio say Madam owo for Reclamation nor wan gree stop her dirty. See where she dey cook see dirty suck away pit. See dirty water wey dem take dey rinse tiko put for soup as e black. The beans wey she take dey do owo beans, dem nor dey select am. Dem just rinse am pack put for pot, chaff and all. Abeg make unu change bcos we nor fit use our hand buy wetin go pain our belle. This weda too cool and cold dey catch my left hand. Abeg wetin i go do to off dis cool becos e dey affect my brain? God Bless Sapele. SAPELE/DELTA STATE MUST BETTER.
Posted on: Tue, 23 Sep 2014 18:38:55 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015