P.m News/Updates. 23/11/2014. Report land studio thru Bethel - TopicsExpress



          

P.m News/Updates. 23/11/2014. Report land studio thru Bethel Baptist Roof say The families of Late Smart Gabari Ogbimi don dey use deir hands dey call for Unilateral fight. Ogbegbe wife wey be d senior Daughter for the family don use deir late Papa House rent finish and she nor gree go her Husband House again go stay. And d senior boy wen be Andrew. A.k.a Ajakan dat one dey stay pupsy compound for Adeole there. Him dey collect house rent too. Benjamin wey be my far smally in those days still join dey rent deir Papa property out without say dem carry the junior ones along. As i dey report so some of the junior Ogbimis don dey Gym,some dey run round stadium dey exercise say dem get War against the Ogbimi Colonial masters wey nor wan gree make dem share the late man property. Benji oya cum inbox make we yarn. Report enter studio through Oghenetega Baptist Church toilet say one black Mecedez Benz just jam one Blue Keke for New Road by that woman church dis morning. The benz fold and the Keke fold small. Na so the owner of the Benz wey wear red shirt just dey squeeze face like who buy market,why d Keke man dey pick e parts from ground. Make unu carry unu selves go MTD if the issue pass unu hand to settle. Report enter studio through Okpe Community Baptist Church say CHURCH AMAZING don dey over dey loose members for deir church like St. Patricks Catholic Church wey nor dey full again becos of deir Military Rev Papa. As big as Church AMAZING na only 3 Cars nai park for deir outside and so so space nai full the church hall wey people sidon put. Dis na sign of lack of good programmes and poor welfare package. Make unu cum my Church BETHEL BAPTIST make unu see how we dey use money dey encourage members. Report enter studio say the State Government don commence serious work on the road expansion of Sapele/Warri Road and dem don grade the left side of the road,wen u dey come from Warri side and also them don dey complete the side wey Senator Dr Eferakeya Hospital dey. This project nor satisfy my appetite and i go comment on am soon. Report enter studio say all the Catholic Churches wey dey Sapele and infact Nigeria dey waka for dis Agbadadururu hot sun,as deir Pastors carry one thing dey waka. We all kneel down for studio join faith with dis Ogbonge Church say as dem dey waka dey dance,dey pray and dey shout praises to God,say make God answer our prayers say make Sapele better and make women wey dey born nor die again for Sapele and make we nor dey bury young people again for Sapele rather we all go dey better and na better better things go dey follow us for dis Sapele and Delta State wey we dey so. IJN Amen. Report use Pastor Isreal shoe enter studio say CAC church for Commercial Avenue the service bam wel wel, the choristers nor too dey sing old skul song again since after my last post about the church. I notice for unu church say after unu opening prayer unu nor dey sing praise and worship at all, atleast unu for dey do dat for about 30mins and the choir nor dey sing dia special number abi unu nor dey go practice again? Where i for take clap for unu church na so so marriage unu dey celebrate for the church dat na good thing. Ilori just dey draw line now becos na we 2 go sing for the marriages wen unu dey celebrate for unu church ooo. All the way from the backyard of Olympia, report nack our front yard gate say, Winners Chapel Crudas road services na ogbonge as the message of godliness use hand take touch ground. I don dey talk about some people wey e be say anything pastor dey preach nai dem take dey come outside dey gist or do notice me. Kingsley, Toju, Obi (Tortoise head) and other instrumentalist, abeg, if unu know say the message wey pastor dey preach dey hot unu body, make unu kukuma dey sidon for house or make unu attend the deliverance service so dat the waka about spirit commot for unu body. This also apply to all those notice me people also. Unu know unu sef. I go soon start to dey mention unu names. Deacon Andrew nai lead the choir ministration today. Since I advice am, he nor come dey carry stretch dat he neck as before whenever he dey sing. Winners Crudas road... As a province for Sapele, na which kind road unu say unu do? I believe say that na patch-patch project nai be dat. Unu block road say unu dey repair crudas road entrance but at the end, na patchy-patchy nai we take our eyes see. We go dey complain say our government nor dey construct our roads well but see the one wey unu take unu hand take do through Direct Labour Agency (DLA). As a church wey get name, dat road na below standard. I just hope say dat road project neva finish. Engineer Gbenga take note. Report enter studio thru GOD CHOSEN CHURCH mic say na Gift aka Bakpor and Sunday nai do marriage for dat open space compound wen dey near Ogbimi compound for Adeola Road, the marriage carri growth but pipo nor see food eat becos dem just focus on so so meeting pipo and pool agent cos the girl na one of the pool agent. Dem just invite all the people wey dey Jesse and all the Jesse pipo just dey complain say even pure water dem nor see drink, i manage eat 2 plates of rice make my belle for cool dis evening. The Boy just sqeeze face like say na Lapo e from borrow e marriage money becos e do like who dey hold debt, na wen the Girl dey tel am to smile nai i just commot for dere wit my N55 Cheque wen i won spray b4. Report jump the fence of Gods Grace Church enter studio say e get one man wey dey enter old bushy Nitel by warders barrack for Orhorho Rd and e dey call himself snake man. E dey do like small psycho,weda e dey pretend we nor know sha cos all of dem wey dey do bad thing dey always form say dem dey crase! Dis man go enter there dey find snakes and wen e catch dem e dey put dem inside one dirty old traveling bag wey be like Jimtex bag. E nor dey talk to person,e nor dey greet and nobody know where e from dey com or wetin e dey use the snakes do. Yesterday morning around nine some children wey go pick umukurubu for that swamp for Reclamation by Omamagho compound con see d snake man inside the bush, he make fire and he chook stick inside one long snake dey roast. The children con shock run as dem turn dey run nai dis man open the bag root out one snake take stone one of d children aiming for make d snake bite d pikin but e con fall however e touch d pikin for shoulder. Some boys enter d bush to go rough handle d man but wen dem near am e do like say e wan unzip the bag to pour the snakes out,nai the boys pick race. Abeg anything wey the appropriate quarters go fit do,make dem do to tackle this man bcos na threat e be to the pipo wey dey stay dat area. Report jump enta studio say some group of guys don dey tear d poster of Hon. Chief Felix Ureumesiri Anirah. Dat na poster wey Sapele Most oldest teneat b4 wan take enta Houx of Assembly but guys don dey vex say dem nor want am for seat as d masses need fresh blood to represent Sapele since dis ancient town dey seek for Change and not pocket infrastructure. Report use Church Of God Mission pastor long sleeve enter studio say Sapele girls nor dey wan hustle with their hand and e bad well well. D way different pipo and social medias especially sapele Oghenek dey preach against yeye life and ashawo work suppose to don make dem change to a large extent! But NO! MBAH!!! D more the talk d more dem dey go haywire! The IN-THING now na for some set of sapele girls I know dem some reach house. Na to dey go baff for spiritual houses for Abbey and environs make dia kpekus market for dey sell well and to dey get big boys wey go dey spend for dem! Afoke Umukoro for Chude lane by Akintola rd ,you better listen! Dat specialeye-shadow and lip glosswey u go do with 12thousand five hundred naira nor go help you better face your sewing wey u nor learn finish and troway dose devilish fetish things wey you go do come on Friday! Report zoom enta studio say na Felix a.k.a Fela nai marry the woman wey don born almost 3 children for am today. The party full jam with native yahoo boys as fela broda wey dem dey call Ochuko wey do belle like purge juss dey waka zabu-zabu dey follow d venue. The rice smell raw mess as d meat nor get beta weight. Naso retired opio still full d ground as dem begin do bleaching competition naso Fela begin dance with e gorimakpa like who win Naira Bet. Hon. Moday Igbuya and Hon. Felix Anirah declare today base on deir Political interest for 2015. News Later. God Bless Sapele. SAPELE/DELTA STATE MUST BETTER.
Posted on: Sun, 23 Nov 2014 18:32:06 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015