P.m News/Updates. 26/06/2014. Report use sosorobia perfume - TopicsExpress



          

P.m News/Updates. 26/06/2014. Report use sosorobia perfume enter studio today our state Governor use anger dodge enter dis town today due to dis morning post against the non inclusion of Sapele for 2014 Budget and d promised dualization of Gana Rd to Ugberikoko Road. As we dey report so our informer don alert us say na d expected space of where d demolition team go bulldoze reach. We dey use dis update dey notify all unu wey dey Gana to by now dey pack unu things for Gana Must Go to unu nearby neighbour Houses. Also we dey alert all unu now say Delta State Governor Emmanuel Uduaghan go visit all d affected places wey dem demolish for Sapele to see the work so far. If unu like make unu nor tell am unu pains. Report enta studio say during d demolition exercise today, Hon Ben Igbakpa use he power take scata Omoraka soak away and fence wey he use take block road for he houx wey dey New Rd. According to d report, dat place link to Poultry Rd down to Shell Rd by Orodje, but d wicked Omoraka use he hand take build fence and soak away take block d Road. As we dey update so, d road don open wah and pipo and cars fit pass d road now. Also d demolition crew still burn one craze man houx wey dey New Rd near Obule houx as report reach our news desk say dem see laptop, tv, generator and oda valuables including hot drinkr for d craze duplex. We go kip unu posted. Report reach us from the demolishing team say dem ready to go back to anywhere wey we order dem to becos e nor dey possible for dem to see everywhere during the demolision becos dem nor perfect finish and dem also agree say bad eggs for deir group nai dey go collect bribe from pipo and if we fit give dem d numbers and addresses dem go re- go back go demolish d buildings. So who know any compound wey dem for do magomago make dem also send d address enter our inbox so dat we go compile am send am give Hon. Frank Omare. Also we dey correct Noon News as dem nor demolish Alinco shop but na 10/10 new store dem bring down. Report enter studio say Sapele/Delta State go experience special Sanitation dis Saturday and Special Security squads nai go enter d town to monitor the sanitation. We dey use dis update dey inform all married couples to be, to push deir time go after d enviromental sanitation and also make unu come out to clean unu environment very well make Army nor use unu do highlight. Report enter studio say Army escort dem Hon. Ben Igbakpa enter market road go inspect all where dem don demolish pass nai dem see one boy wey dey sell Salad Things wey dem dey call Fred dey sell for Road. Na so Army use d Boy take do flogging excercise as dem design d boy back wit Doro-koboko. Dem cum also slice d boy things throway. Report enter studio say Hon. Omare and Hon. Ben Igbakpa enter Market today again, as dem cum dey pursue pipo wey dey sell for Road. As one Girl wey dey sell Imekpe wey Hon. Ben Igbakpa wife dey owe money run wit her train of Imekpe enter one shop nai Hon. Ben Igbakpa enter d store go drag d Girl come out from d store nai e turn all d Girl perishable Imekpe for ground.Damage all of dem. Hon. Ben Igbakpa u don enter my trouble for dis evil act or u find that Girl go pay for d damage wey u cos to dat poor family. According to our reporter na Hawk d Girl dey Hawk but wen she wan sell for person nai she carry d load down. Also dis Ozighe Hon. Ben Igbakpa still loose all d cars wey park for the market road plate numbers due to say dem park for d road. I wonder where unu say make pipo park cars put, go buy things from the market. Report reach us today say BEDC don chop big bribe from Sawmill pipo as dem don promise to dey give Light to Sawmill against the normal 4/4 Hours wey dem dey share d light. Na since morning nai Sawmill side get light and Adeola Rd to Abeke Rd go Gana dey black out. Even Shell Rd, Ugbeyiyi, Okpe Rd and environs nor too dey get lite again and these useless BEDC still carry ladder dey cut pipo light indiscriminately against deir Human Right. BEDC! BEDC!! BEDC!!! I nor go call unu pass so again. I need qualified Electrical Engineer with Accountant for employment within and outside Sapele. If anybody dey interested make e visit inbox for Interview. I nor go answer any question publicly. Today we use Heavenly perfume of LONG LIFE wey dem mix with the powder of PROSPERITY nai we take rub the body of Mrs ESEOGHENE TONUKARI as na today nai be her Birthday. We use d banga of BREAKTHROUG and fresh fish of GOOD HEALTH take cook the OWHO-EDI of RICHES for u today. Na evalasting cattarh nai go be d portion of ur enemies as we use PHINA SCERRI earing and MRS FELDMAN bangle take wage kola nut for u today. God Bless Sapele. SAPELE/DELTA STATE MUST BETTER.
Posted on: Thu, 26 Jun 2014 19:56:06 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015