P.m News/Updates. Report crip enter our Studio say Pastor - TopicsExpress



          

P.m News/Updates. Report crip enter our Studio say Pastor Adebowale wey dey CAC for Adagbo Lane hold meeting dis sunday wen pass so,base on d Mission House money wen dem dey eat,wey we unveil d secret. Mr Oladejor and Actor make unu do 40days fasting and prayer for unu sins of thiefy thiefy of Mission money. We apologise to Mr Mukoro wen we count join dis 2 big agbalagba,na becos say we dey see u wit dem nai make we feel say u dey among dem. We thank Pastor Jide as e helep us handle d mata. I dey beg all unu say as i don open unu yanch so,make unu join hand helep unu Harvest committee so dat unu Harvest go make sense. I hereby move motion say Mr Oladejor and Actor mak dem commot from d position wey dem dey occupy. I dey cum unu Harvest 8th of December,mak unu put my name for unu Programme. Disaster don struck PHCN for Amukpe,as d giant Crane wen dem rent wit N250,000 wen dey work 2 mount d new Transformer don turn upside down. We dey beg all unu say mak unu bear small as d Engineers dey try deir best to fix the Transformer. Accountant for Levant Construction Company Sapele all d money wey u take pay ur workers don conderm no body fit use am all na money wey bank don reject and bank no gree collect am 4rm dem. If Devil wicked,nai be say u wicked pass Devil. Late Okpeyor wen die for Joseph Swamp last sunday after e go Shetti Party. Dem go Bere am dis Saturday for Big Warri and after then we go do e reception for Crowder Primary School as from 2p.m. The Late Man wife born today and na Boy nai she born. Infact Okpeyor don cum back to dis world again. We dey call on Hon. Micheal Diden,Godwin Ebosa my Oga,Oyibo Ebosa,Francis Maku to go visit dis Woman wit envelope. The pipo of Uduaghan Park, Sapele Branch, na dirty go do unu sometin. See as unu park dey smell rotten fish yesterday, for the side wen dem dey sell ticket. No vetilation and no chairs for pipo to sit down. Every where just make zigi-zigi and faren- faren. Make dos ticket sellers Girls dey baff well and dress well dey come work. The Obituary Poster wen dem design for Late Ademi Obi, d tin big like 60 inches Plasma. Na dis Saturday, 9th Nov. 2013, nai dem go do d burial for e houx wen dey Owumi. While on Sunday, 10th Nov. 2013, dem go do Thanksgiving Service for Oghenetega Baptist Church. Sapele Tafia Crew go dey d ground as we dey draw ear for Jubilee, Blessing, Mayor, Major, Colnel, Kingsley, Emmanuel e.t.c, if I nor c beer drink, na war. Lolx. Na joke o. We sympathize with unu as unu papa reach 95 yrs before e kpuff. We dey send our prayers as we pour drink for ground, go meet IGHO FC SAPELE as dem go battle AKOMA FC WARRI, dis coming Sunday wen be 10th Nov. 2013 for Ughelli Stadium. Na dis game go decide who be d true Champion for Delta State Division One League. Make unu play well as we dey urge the Players and Coaching crew to do Fasting and Prayer on Friday. Make unu, make sure say unu nor doke babes from now till dat day, most especially u, Ifeanyin, Pius, Fejiro and Awo e.t.c. We wish unu succes and victory. We throway birthday greetings give MOG ENTERTAINMENT (Mogbejule Luckh) as e clock plus one today. E celebrate with d Orhanage today for Madam Buwa Orhanage home and e lata do Thanksgiving dis evening for Winners Chapel. We wish am many more years ahead. JOLOMI BOYO, U DEY TRY ME? Ur Gbwa dey fridge, we go soon defroze am,and na after u don cure ur Malaria finish nai we go nack u d bomb. Solomon Abeke as u drive enter Sapele Okpe Hall dis afternoon na 2 Girls ur Motor produce and na so u use eye look deir yanch till dem waka reach gate. Na wa for u oh,mak u try d do like better leader,wen i dey feel say u be. From our Studio,we don decide to send 4 names *Elendu Duke. *Alamikoko Innocent. *Akpobi Sophia. *Bawo Valentino Obakpe mak unu go resume and learn the HSE Training for Mission Rd as from tomorrow for Mission Rd by Water Board as Dr Edward Carpe sponsor 2 Persons. Mr Randy Okotie Richard (Richard Continental Hotel owner) sponsor 2 Persons also. We also dey beg and dey wait Hon. Apiam,Tony Amusu,Simeon Billion,Franca Uwanoghor (my grand mama)and my smally James Opuro Jimmy and any oda person wen go like helep our youths from dis forum,to assist as d Training don already start today. My people make we join hands clap for Mr Randy and Dr Carpe for deir wonderful support. Also we pray say make God refil and bless unu beyond wetin unu ask for In Jesus Name. Amen. We throway congratulation give our Delta State Under 17 wen dey Dubai as dem win Sweden for Semi Final. I dey go Dubai 2moro dey go watch d Final match. Who wan go mak e inbox me,sofa u go follow me sleep bedi ground for 7days. SAPELE/DELTA STATE MUST BETTER.
Posted on: Tue, 05 Nov 2013 19:48:24 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015