P.m News/Updates. Two Boys gada rape one Girl of 19yrs,for near - TopicsExpress



          

P.m News/Updates. Two Boys gada rape one Girl of 19yrs,for near Vifa Church dis evening (names witheld). As we dey interview d Girl wen we see dey cry for Road,she say d Boys dey waka follow her from back from Lexi Rd,after she reach one dark spot nai dem force her enter near one bad spot,rape her,collect her phone,run leave her. We dey warn Sapele Boys and dat 2 Boys in particular say na death dey invite dem so,if dem nor put an end to dat evil act. We congratulate Mr Precious Izobo and Mr Oyibo Ebosa as d two of dem arrive London dis evening in good health. We dey call on unu wen dem travel leave say make unu nor wori,say dem go soon come back. Treasure my Love nor cry again,very soon,u go soon go U.K go continue ur School. L.G wen dey Olympia as unu tanda celebrate Independence Day wit swag,na so our God go helep bless unu. Na only unu nai drop Keke wit green&white decoration and D.J. Some group of Boys wey get Babes for Ashawo Hotel,wen dem post deir names on Sunday. Gada demselves go Beer Parlour say "dem done be star" becos say Sapele Tafia carry deir name. Dem just dey fool deir old age. Sapele Stadium come alive today again, as report waka enter our studio say men, guys and babes enter d stadium to show their support dis afternoon wen "Sundorf Academy Sapele" host "Igho Fc Sapele", for a local derby. The game end 1-1. Na Igho Fc dey win before, but their players con dey play 'smel-smel' nai Sundorf Academy nack the equalizer put for die minute through one powerful free kick. The game balance sha, but if to say Igho Fc win today game before, dem for top the league. I congratulate Dr Ofuafo and e Sundorf Academy team, most especially dat guy wen dem dey call Igweh, as dem play thier heart out today. MR OSIOWAN IGBUYA, dat ur house wen dey Fovie Lane ( Okpe United formal camp ), abeg go put Road for d place wen lead to ur houx house. Na so You and ur Agent dey deceive pipo say, before dem go park enter d houx, u go don do d Road. And after dem don pay u money, u go forget about dem. Up till now, no road. Na pipo fence ur tenants dey jump dey enter houx. Dat na shame to u Oga Osiowan Igbuya. Just early last month nai we raise alarm from our studio, of how cars dey park anyhow along Okpe Rd. We con even suggest to Hon. Egbedi to set up credible committee to dey lock pipo cars wen park anyhow for d road. Just dis morning nai report enter my studio say some pipo dey lock pipo cars wen carry park along Okpe Road. We know say na good tin, but who instruct dem? And if na u Oga Egbedi nai instruct dem, why u nor give d masses notice through annoucements and town criers? Wetin my eye see for Secretariat today wen I go inspect those 3 transformers wen dem put there, I nor like am. Oga Egbedi, warn dat ur thief driver. He carry money wen Uvwie Local Government Area Chairman use take dash Comedians. D comedians come mit u (Egbedi) to support dem for their forth coming show, u dey 'poscute' dem. Dem see D Uvwie Chairman now, dem rag am, ur driver just block dem, collect d small 10k, run enter motor. I give dat ur Driver 24hours to return dat money, if not, na d "Gbwa" wen i go release nai go cure e sense! Unu wen dey play Gamble for dat Barbing Saloon wen dey Shell Rd Junction by New Rd, atink unu nor wan stop? Na Army go come direct unu brain very soon. LONG LIVE NIGERIA. SAPELE/DELTA STATE MUST BETTER.
Posted on: Wed, 02 Oct 2013 19:37:47 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015