PM NEWS/UPDATES. 18/4/2014 Report land our studio say the - TopicsExpress



          

PM NEWS/UPDATES. 18/4/2014 Report land our studio say the wife of the State Governor, Mrs Roli Uduaghan don troway advise give Journalists wen dey Delta State say make dem dey verify facts and figures before dem dey publish their reports to avoid misleading the public. She give dis advise for d Solemn Assembly wen the Nigeria Union of Journalists Delta State Chapter organize recently for Asaba. We con use dis to channel to all our Jounarlist wen dey Sapele, especially Nelson Agbajor and Onos Itachemi to dey report wetin dem see as dem don dey broadcast for different print and electronic media, project wen norva complete, dem go say dem don complete am. Na such report dey carry Sapele dey go back so. Our studio nor go relent within our power to expose all d bad, bad tins wen dey go on for dis town wen all these fake journalist dey hide. Na dis Sapele unu dey, wen we nor get Market but unu dey hide from public view as against the progress of dis town. SAY NO TO SUGAR COATED JOURNALISTS TODAY. Report run enter studio say dem suspend d 2 co-operatives wen dey DESOPADEC for 10 Months now sake of say dem suspect foul play. Since den, dem dey collect money at source from co-operators without remitting to d co-operative accounts. Even people wen collect loan b4 d suspension wen don pay finish, deduction dey go on as if say dem still dey owe. 1) wen dem want to lift d suspension?, ten months nor too much 2 do investigation? 2) Hope people money wen dem no dey pay into co-operative account dey safe, say smbody no dey pull job wit d money dey delay lifting of d suspension wit style? 3) d reason wen make people join co-operative na to enjoy its benefits but now dem don deny co-operator dis for 10 months now & we nor know if e go reach 12months. 4) if dem nor get confidence again for d old executives, make dem make move to bring in new ones. Na here i talk dis one reach and i want make unu act fast before things go spoil. Emeka and Progress wen be Ebbah daughter do their traditional marriage today for Ebbah compound for Orhoro road, everything dey, drink and food surplus. Na tomorrow be d wedding for PRAISE CENTRE wen be former POINT and KILL and i go M.C the occassion. I dey expect unu to show the ground becos i wan dash free Recharge card tomorrow. Report use Lilon motor take enter studio say na up to 26 girls wey come write jamb for Okotie Eboh Grammer School nai Ikomi and Rena Road boys rape on friday night. Collect their money and phones. As i dey post so some of d Girls don go into fasting and prayer against dis uncurable pains wey dis boys put them. Sapele boys i don c am say na unu dey use unu hands dey call curse for unu generations. Report reach our studio say Catholic Church wey dey Yoruba Rd use leg act Jesus Christ film follow Sapele today and na one Sunday Umuti nai be the Jesus. Catholic soldiers wey flog and kill Jesus na Army. If na so nai be say e don tey wey Army dey do bad dey cum oh. Dat accident wen happen 4 Akintola Junction, report twist body like ugbene enter our studio say na Army nai cos am. Army dis unu ova unproffessional way of blocking okada don dey too much 4 dis town. Pastor Godspower Imido ex wife wen dem dey call Maureen, don enter anoda life as she don dey dress provocatively dey expose her yellow lap to entice men. Madam, abeg, make u try hold God strong and make u leave d kind of Life wen u dey live so. So dat God go answer ur prayer to put d Devil to shame. Na advice oh, nor be curse. We salute BEDC, as dem don rectify d fault wen d Lite get. Report twist like Snake Girl enter our studio say, some parts of d town don regain constant electricity supply since yesterday nite. Oya, if ur area transformer get problem, make unu 4ward unu complain to BEDC ofiz. We troway happy belated Birthday to Ovigwe Egbonoje. Na yesterday nai he clock plus one. Oga Ovigwe, na ur committee of friends nai say make we use boxers take stand on top Ganro Upstair take wish u Happy Birthday. We use Long Life and Prosperity take sama dat ur karnel head as we use siren take blow fresh brezee of Brakthrough for ur body. U go excel for Life. Dem say make we use Kayode of Sapele integreted with e fat belle, Emmanuel Agbaje, Moses Egbejule, Sheke Egbonoje and my two black yanch take wage kola nut for u. God Bless Sapele SAPELE/DELTA STATE MUST BETTER.
Posted on: Fri, 18 Apr 2014 18:24:30 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015