PM NEWS/UPDATES 6/5/2014 Report cum from Oghene Road - TopicsExpress



          

PM NEWS/UPDATES 6/5/2014 Report cum from Oghene Road extension say the people wen dey over they pollute dat Oghene Road extention na Ogude, notin pass God, dat man wen get supermarket 4 Yoruba Road Junction by Cementry Rd. Unu nor dey patronize people wen dey carry dirty again na to dey carry dirty from unu stores dey cum dump for front of people houses dey cos environmental hazard nai unu sabi. Make unu try amend unu ways as we dey call on Sapele Local Government Council Chairman to send e team of boys to come pack d dirty and post say anybody wen dem catch wey throway dirty dere again go pay N10,000. Na yesterday nite, nai Ogude throway fresh dirty dere and d tin don almost dey block the road. Report enter studio today say na National Association of deaf nai dey go hospital every evening dey go see deir member wey drink heavily cum go dey ride bike wey get accident and dem cum rush am come General Hospital. Na 21 deaf nai present dere dis evening as dem just dey use hand dey describe like say war dey come. The deaf guy wey get d accident na 2 wives e even get and na different deaf babes dem trip in dey cum see am. Report run enter studio dis evening say General Hospital small doctors don turn the doctors quarter to ashawo hotel as na different girls dey troop in the place for only night hours. I cum dey wonder weda dem dey do virgina operations without pain for dere, becos nor be small screen one girl screen wey go visit one smallish doctor wey dey the quarters dis evening. Infact i dey come for unu, make unu wait for me. Report run enter studio say Omasan Olololo assist about 5 boys wey get problem with Topfeed company as d Union refused to pay dem before due to say dem be one sideline deir fund but wen Olololo intervene wen d boys lock d company gate, d company cum call DPO and ARMY but d boys call Hon. Ejele wey call DPO and ARMY to free d boys say dem dey fight for deir RIGHT nai e call Omasan to intervene and wen my smally Omasan cum intervene dem cum pay d boys N100,000 each. I still get issues wit some 5 names and i dey call on WALE, OMASAN AND MOSES OGODO to assist dis boys or else i go come lock d gate soon. Report run enter studio say the Orodje case with the Ugborhen Community supposed chairman say dem adjoined the case to 18th of june next month. I don talk am before and i go talk am again, make dis issue end for round table for palace. Chief Lucky Ayomanor don buy one jetta motor give d vigilante group wen dey Elume District to encourage dem to fight d criminal activities wen dey dat rural area, d vigilantee Commander with e boys just dey happy dey drink beer. Victor Ukweje wen be Elume Junction chairman con dey do body guard dey follow Chief Lucky Ayomanor while David Urhiri just open e big mouth 4 ground dey laugh. All dis vigilantee boys make unu use d motor 4 d purpose wen make dem buy am bcos i dey elume junction with Ugborhen chairman Patrick dey drink wen unu drive come i nor knw were unu dey come from make unu get sense o i dey top of David Urhiri ceiling dey watch unu. That girl wen get butik for Commercial Avenue by Green Egbedi. As u say u nor wan rest ur ring boiler so, afta u don use jax take dey golobi men for dis town, na me go personally disgrace u for dis town. Ur gbwa dey inside MESS 20 Pepper Soup. We go soon share am drink. Proustutated animal. Report cum say the Lawrence Road when them tarred without drainage they suffer pipo for that area especially when rain fall. Water nor dey fit flow well enter the Major Bowen Road drainage. Sunday Nwankego house 4 d end side of Major Bowen, he fill the front side of him gate cover drainage, e make water nor come they rush well 2 d swamp. The main rainy season never reach oh,when that time reach water go enter people houses for dere and homelessness don yamutu oh. I dey call on DESOPADEC Boss to look into dis Lawrence Rd issue. God Bless Sapele SAPELE/DELTA STATE MUST BETTER.
Posted on: Tue, 06 May 2014 19:33:45 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015