PM NEWS/UPDATES. 8/4/2014 The wife of Oga Julius Egbedi, wen - TopicsExpress



          

PM NEWS/UPDATES. 8/4/2014 The wife of Oga Julius Egbedi, wen dem dey call Mrs Rashidat Egbedi nai empower some selected farmers with fetilizer and cassava stem yesterday for Sapele Local Goverment Area Secretariat. Dis empowerment dey under d benefit of the Delta State Government. Report use groundnut kanda take fly enter our studio say One Pastor for dis town don give one of he female member belle. Our studio go keep unu updated with dis latest of dis update. Report from Benin say wen dem dey go one good samaritan from dis forum wey dey Obodoyibo wey nor want make we mention e name send person to block the Authomatic Abulance wey we use carry our Juliet Efetobor Afinotan for Ring Road and d person punch dem N20K to add to the initial money. When dem reach the Hospital d first Doctor wey attend to her say dis case pass e power but another expert cum direct dem go for different Test and the first 2 Test show say her blood norva dey infected despite the bed sour wey she don get due to say she don too tey for one place. As we dey talk now she don enter Admission pending subsequent test before d final operation. We still dey work on sometins to display the proposed Account for our contributions. We dey use dis update dey Thank Baba God as e use our studio take grant one Mr James Iwo from dis our studio good job for one of the oil firm within Sapele. We thank d company as we pray make God bless d company for the confidence wey e throway give us to recommend worker. We also use dis update to draw ear for the employee to wear e best character so dat we go dey get subsequent offers. Dat company wen dey New Rd after Humprey Idisi houx, opposite Obire Rd, dem don use their big carterpillar take destroy d corotar wen dey front of their company. We dey use dis update dey direct d said company to go replace d corotar wen dey front of dat place wen dem don destroy, oda wise na me and unu go dig am. Unu write SAFETY FIRST for unu blue gate and unu dey destroy Government property. Make unu try me first. Report use 911 take jam our studio say some boys don dey collect N100 each from Itie street so dat dem go use am take fix their transformer wen break down since for d past 10 days. Now BEDC, na d area pipo go contribute to unu b4 unu go buy wetin dem vandalized for transformer? Why dem con dey pay bill now? Old and retired World and Local ayangba wen dem dey call Ufuoma wen dey stay Jakpor Rd by Ufuomanefe Rd opposite Great Child School. Dis yeye Mother of half dozen don use her kponyor as public waste and ambulance. She don dey recruit oda old poli like am as dem dey use their old pillar feeder take dey hustle banana dey follow every part of d town. Ufuoma, na dat ur store wen dey dat ur Papa sister compound nai u don dey use as ur ashawo depot now. If u nor stop dis ur waka-waka, HIV go use take do provision store. Yeye old ogberanre We troway Happy Birthday greetings to Lilian Eghagara as na today nai she clock plus one on earth. We wish her all d good tins of life as we use thunder of Long Life and Prosperity take blast her fall yankata. From our studio we dey ask unu to pray for Tafia Okpubuluku as sickness tire am for bed here. We dey solicit for unu endless prayers so dat he go bounce back soon. Keep Sapele Clean God Bless Sapele SAPELE/DELTA STATE MUST BETTER
Posted on: Tue, 08 Apr 2014 19:24:57 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015