PM NEWS/UPDATES. We start our PM update on a very sad note - TopicsExpress



          

PM NEWS/UPDATES. We start our PM update on a very sad note as STANLEY JAKPA don finally kpuff for UBTH dis evening. Stanley Jakpa go use carelessness take go pour fuel for Generator wen dey work. Before Late Stanley Jakpa know wetin dey happen, na fire nai burst out gbwa. D fire roast Stanley beyond recognition. Na for Asaba nai dis ugly incident for happen and na dis evening nai Stanley finally die after he spend critical moments for UBTH bed. We nor know which kind mistake Stanley do but we lite one candle for we studio take pray for he soul to rest in peace. All students of Delta State University DELSU Abraka wen dey dis forum, unu Vice Chancellor don troway info enter our studio thru one of unu lecturers Mr Biri say dem don call off their ASUU strike and lectures go resume on Mon December 9th 2013. Oya make unu ready to go resume as my eyes go still naked for unu body for gbwa if unu carry do and carry waka. Brorhie wey her guy dey sell clothes for Boyo rd opposite Sista Omatsan store nor gree comot from d street of ayangba D guy store for Cemetery Rd, na Brorhie nai dey manage am but yet she nor wan put her head down, wen she go buy goods for Onitsha na so she dey sight folow all d Ibo mugus, dey form love relationship make dem for give her cheap article guds, then wen she return she go, go camp wit d innocent bros wey love her wit all e soul Ojevwe wen go burst dat boy yanch for London Royal Hotel, na Okirighwre nai he dey stay, he papa get one compound for Okirighwre and na the compound he dey stay as he dey spin all the young boys 4 Okirighwre and he go dey use Blackberry take dey bribe dem. Na so, so native shirt and chief title wen e papa die leave nai e take dey show e sef 4 okirighwre. Hand go soon touch am and we go publish d houx address soon. Puyeye wen e be gay too wen e get Indomie store 4 Amukpe after former Semikolo Filling Station for opposit Oghene Road for Amukpe, d guy don finally get Church as na him be the pastor of the church and na Gay Church nai he don use sense do so, the name of the church we go confirm am. Oga Moses Ogodo, the pipo wen ur foundation sponsor go the HSE training, d Director of Aigedosin Nig Ltd don troway report enter our studio say he nor go allow dem 2 continue as from 2moro bcos you Oga Moses Ogodo promise to pay d balance money today (wednesday) afta d initial deposit of 100K. And u norva fulfil d promise. Oga Moses Ogodo, nor fall ur hand. Wat is worth doin is worth doin well. Try pay d balance 2mrw so dat d pipo wen u sponsor go fit continue their HSE training. Sarah wen yellow wen get store for New Rd for bottom of that white upstair wen dey near Christ Chosen Church after Dadi Upstairs. U don bleach scata body and u don use ur kponyor take dey dig Ring Well dey follow Sapele. Na d way ur store be since January, na so e be dis December. U nor dey sell becos of ur doking spree. All ur yanch wen set te-te-te before, don draw take and na so, so, baragada nai u dey baragada dey waka. If u nor stop carry do, na dat ur picture wen u put for ur sign board nai I go scata. Oga Okoye Martin Joe wen get Nandy Supermarket, wetin dey happen to ur Super Market? Ur super market don be like provision store finish and everywhere just dey dry for where u dey shade goods put and ur prices just dey go up by 50%. Try beef up. Jesus Heals Clinic don dey re-paint he hospital ahead of the xmas. Na wa. Oga doctor, na so, so paint nai u dey paint ur clinic? Unu wan use d Clinic take contest for beauty pagent? Unu gbwa dey fry pan. I go soon release am. OMEGAPRINCE Present FACE OF SAPELE Live and direct @ Richard Continental Hotels. Saturday December 7th 2013 by 3p.m. Full Details lata. SAPELE/DELTA STATE MUST BETTER.
Posted on: Wed, 04 Dec 2013 19:46:26 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015