PSALM 23 IN PIDGIN ENGLISH 1. The Lord na my shepard. I dey - TopicsExpress



          

PSALM 23 IN PIDGIN ENGLISH 1. The Lord na my shepard. I dey kampe. 2. E make me sidon for where better dey flow and come put me next to stream make my body thermacool. 3. E panel beat my soul come spray am white, come dey lead me dey go through express road of righteousness because of Hin name. ... 4. Walaii! If I waka pass where arm robber, 419 and juju people boku, come even join boko haram, reach valley of the shadow of death sef, liver no go fail me. Your rod and staff nko? Na so dem dey like backbone dey comfort me. 5. You don arrange good food on top table make I chop. See bad belle people dey look waa waa. You rub me for head with vaseline intensive lotion. My cup come be like River Niger dey troway dey go. 6. True true, better life and mercy go dey follow me till I quench. And I go tanda gidigba for the house of Chineke from lai lai to lai lai. God Almighty, Na you biko! AMEN..... ;)good mowi pals
Posted on: Tue, 27 Aug 2013 05:23:55 +0000

Trending Topics



ght:30px;">
ddqwupswmi
PTPA Do you want to earn 10,000-100,000 per week and lifetime
Land for sale in Jimbaran by Bali Real Property. Property in
TUNE IN this Saturday LIVE@5 to TradioVs Artful Undress Kira &
Muy buenos días de martes y bonito día en sus trabajos o en sus

Recently Viewed Topics




© 2015