PSALM 23 IN PIDGIN ENGLISH 1. The lord na my shepard. i dey - TopicsExpress



          

PSALM 23 IN PIDGIN ENGLISH 1. The lord na my shepard. i dey kampe 2. E make me sidon 4 were beta & oringo dey flow & cum put me next to stream make my body dey cooleee cum dey thermacool 3.E panelbeat my soul cum spray am white , cum dey lead me dey go through express road of righteousness because of him name 4. Walahi !!if i waka pass were arm robber, kidnappers, juju people, ritualist , millitan, yahoo yahoo boyz , 419nass, cum even join boko boyz , reach valley of d shadow of death sef, liver no go cut me, ur rod & staff nko? Na so dem dey lyk backbone dey comfort me . 5. U don arrange good food on top table mak i chop. See bad belle people dey look me lyk mumu. U rub me for head wit abolik balm plus maxiton lotion. My cup cum be lyk river niger dey troway dey go . 6. True true , better life & mercy go dey follow me till i quench. And i go dey jolly for d house of chineke God from wahoooo to wahooo. Baba God i troway salute noni.......****###****
Posted on: Thu, 20 Jun 2013 16:22:17 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015