PSALM 23 IN PIDGIN reads: 1. The Lord na my shepherd, idey - TopicsExpress



          

PSALM 23 IN PIDGIN reads: 1. The Lord na my shepherd, idey kampe. 2. E make me sidon for wherebetta dey flowand come put me next to stream make maibodi thermacool. 3. E panel beat mai soul Come spray am white,Come dey lead me dey goThrough expressroad of righteousness sake of Hin name.... 4. Walahi!, if I waka pass wherearmrobber,419 and juju people boku, come even join boko haram reach valley of the shadow of death sef, mai bodi dey inside cloth.Your rod and staff nko ?Na so dem dey like back bonedey comfort me. 5. You don prepare good food on top d table make I chop. All mai enemies dey look waa waa.You rub me for head wit vaselineintensive lotion.mai cup na River Niger weyoverflow hinbank. 6. True true, betta life and mercygo gum mai back till I quench.And man pikin go tanda for Godhouse from lai laito lai la Can somebody shout halleluyah
Posted on: Thu, 22 Aug 2013 11:13:26 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015