People talk say truth no sweet to hear but truth is better than - TopicsExpress



          

People talk say truth no sweet to hear but truth is better than sweet lies. Which kind Job you dey? You be teacher, student, tailor, etc. Shey u dey do am with honesty? Oga teacher shey na with sincerity you dey teach your pikin? Traders nko, shey na right measurement you dey use sell your things? Husband and wife, shey na true love u get for yourselves or you still get somebody somewhere wey dey satisfy you more than partner? "Honesty" - in anything good your hand find doing, Oga make you do am with Honesty because God love an Honest person. Last thing I won say na "Be Honest with God" and He go make your ways prosperous!!
Posted on: Sun, 15 Sep 2013 14:28:47 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015