Pm News/Updates Sapele Tafia dey inform unu say, Sunday Ogba - TopicsExpress



          

Pm News/Updates Sapele Tafia dey inform unu say, Sunday Ogba a.k.a G-One, nor send boys go beat God Grace Ministry Pastors, as some pipo don dey carry rumour for d town say G-one order e boys to beat d pastors yesterday. Dat na Fa! Fa! Fa! Fat Lie! We dey troway welcome salute dey give self acclaimed BISHOP OF THE WHOLE WORLD, Saint Dikeji Mimiyerijesu, d demon destroyer, d Osu and bishop of Gods Grace Ministry as he wear he red garment take storm Sapele for e crusade wen dey go on now for Okpe Grammer School. Na so e patrol follow Sapele today with e entourage. Oga Bishop, we welcome u as we dey call on u, to put the progress of Sapele, as part of ur Prayer Point for dis ur crusade. God Grace! Ministry! G! G!........M! CAC Okiano for Adagbo Lane all unu elders just dey wak unu Church building money. Mr Umukoro wen get plumbing and building materials see as ur life be, ur store nor dey move forward becos of church moni wen u dey eat. Mr Oladejor wen slim, na so so Beer parlour u dey sidon put with Church money. Mr Actor wen dey stay Ugberikoko Rd na all unu dey chop the Church money and unu dey suffer unu Pastor Adebowale as e don grow white hair finish for Tenant. I give unu now till Next month to finish d Mission House or else i go post amuch unu don eat from d Church account. Unu bad character don drive Keku and oda members from unu Church. Big accident happen dis afternoon for Ikomi Road by Ifie road. One woman wen dey work for NEPA, go park her car for Road, nai one bike man go jam d back of the Motor, nai he fall for ground, as e still dey ground, nai another bike climb he head pass. If unu see how d man skull open ehn, unu go forbid to dey chop meat. Na so blood full ground. Dem rush d man go Akwara Hospital. Abel Oyawiri as ur gbogi nor wan rest from small small Girls na me go dash you problem, wen go make u stop to dey carry Girls dey go dat Beer Parlour wen dey Commercial Avenue by Green Egbedi. Na for dere nai unu dey discuss unu evil act. Na so Tuoyo (Shambala Broda) dey make mouth lik say me and am na mate. Elorin wen dey bleach like foreign pig, ur Papa na Pastor, but Jazz nor let u get sense, as na ur pikin Birthday u take do fund raising. Make i see unu control any married woman cum dere again. Abel respect ursef, becos as u dey over cum dere now, e don dey make all those fools wen dey insult u for back dey see u finish. Chuks wen be Police officer for Sapele Main Station. Atink ur eyes don clear now, wen dem don finally stone you go Okirighwre Police Station becos of ur carry do. Dat Cult group wen u join, nai go attack you for us one day. Ike Nwankwo as u dey cari body up dey do like who get many money na so u abadone ur Mama opposite Water Street for Boyo Rd. You dey nack hand for ur chest say unu last Girl pikin nor go marry dat PHCN worker. You wen God pity give better wife from Ishan u still dey branama wit Secondary School Girls follow Sapele. Na Hon. Monday Igbuya nai i go report u give, make e fence ur House cover as e don deal wit u before, but na ur wife nai make i beg for you. Oga Jona Wife Mama Burial wen dem wan do tomorrow, na 5 Police Officers nai go from our main Police Station and na private Motor dem enter go, as dem nor carry Gun or anytin go Federal assignment. MOG ENTERTAINMENT don dey package MR SAPELE EVENT wen go take place for Event Galeria on Dec 1st 2013. According to the organizers, dem say na the 1st time wen dem wan do their event for classic Event Centre. Forms for dis MR. SAPELE na 5k. Ticket: N1000 Regular, VIP, A table for 4 persons 10k, VVIP. A table for 10 persons 20k. Maximum security guarantee. SAPELE/DELTA STATE MUST BETTER.
Posted on: Thu, 31 Oct 2013 22:21:51 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015