Prediction Winner Announcement Make una come see oo. We ask - TopicsExpress



          

Prediction Winner Announcement Make una come see oo. We ask people make dem tell us the name of the Center Referee for the match between Bayelsa United and Enyimba, come give example; come see where people dey copy our example oo. Chai. We use the name Emeka Osas Akpos take do example, people begin copy that name fa. Chai. And e no sweet us because the first person wey get the Prediction correctly, go write Emeka Osas as the center Referee. Can you imagine the conconbility? Bayelsa United 2 - 1 Enyimba (Center Referee: Jelili Ogunmuyiwa) Rules na rules and we must follow the rule. If your Prediction no carry the name of the Center Referee, nothing for you. You don dull yourself ooooo. So na only one person get the complete Prediction and him name na Edet Archibong Edet and we go dash am N1,000 worth of recharge card. Abeg Edet, inbox us your choice of network jare.
Posted on: Sun, 11 May 2014 18:17:39 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015