Psalm 21(pidgin) 1. 1)I swear D lord na my shepard,i - TopicsExpress



          

Psalm 21(pidgin) 1. 1)I swear D lord na my shepard,i kampe 2) E make me sidon 4 where beta dey flow nd come put me next 2 stream make my body thermacool 3) E panel beat my soul come spray am white,come dey lead me dey go thru express road of righteousness becos of him name. 4) walaii if i waka pass where arm robber, 419, juju people, ebola victim come even join boko haram,reach valley of d shadow of death sef, liver no go fail me.Ur rod nd staff nko?Na so dem dey like backbone dey comfort me 5) U don arrange gud food on top table make i chop.c bad bello people dey look waa waa.U rub me 4 head wit vaseline intensive lotion.My cup come be like river niger dey trowey dey go. 6) True True,beta life nd mercy go dey 4low me till i quench.And i go tanda gidigba 4 d house of chineke frm lai lai to lai lai. AMEN
Posted on: Thu, 07 Aug 2014 12:01:00 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015