Rooney na thunder go fire you if you no carry you wahala leave - TopicsExpress



          

Rooney na thunder go fire you if you no carry you wahala leave this club! haba! I don tire for dis guy! If you wan leave, just carry your bag waka make we see beta parson wey we go sign! Everyday, you go bring one stunt wey everybody dey watch. Today, you wan stay! tomorrow you wan leave! wettin! How one confused madman go trouble my man united? Beta players wey pass you like messi, ronaldo, iniesta no dey show body like you! Abeg I take you village juju beg you, if you wan leave quietly carry ur wahala waka! UNITED BEEN DEY BEFORE YOU. Na we been carry trio yet nobody give us headache like you. Eric cantona, Beckham, scholes, ronaldo, Ruud van Nistelrooy, Ole Gunnar Solskjær, Roy Keane and other great futballers wey pass you no giv us this yeye shagara! So if to leave dey hungry you, stop all this nonsense cos th great man untd pass one person!
Posted on: Tue, 16 Jul 2013 19:13:59 +0000

Trending Topics



tbody" style="min-height:30px;">
Hola a todos los que están en mi lista de contactos. Tengo que

Recently Viewed Topics




© 2015