SAPELE/DELTA STATE MUST BETTER. 02/12/2014. HON. HIGH CHIEF - TopicsExpress



          

SAPELE/DELTA STATE MUST BETTER. 02/12/2014. HON. HIGH CHIEF PAULINUS AKPEKI. If day break nai Cork dey crow. Cow nor dey fear water becos of it size. Rat wey get sense dey cross road. Today without fear i stand ontop Okoloko Bridge to declare my stand for Sapele issue. Me when dey preach about the growth of Sapele everyday nor go fit stand to see say people wey nor reach anytin for the hands of God just dey abuse the small office wey dem sidon put. For Delta State here wey we dey so,na Okpe people among the Urhobos nai nor hold better Office for the State affairs,compare to other Tribes,and na dem nai sell deir selves pass to outsiders. He just dey pain me say death norva gree visit some persons wey hold PDP Offices for State affairs and wey dey dictate for the candidates of Office. I dey very disturb right now becos just now wey dem organize local Government Elections within the State,after the Governors throway returning tickets give then PDP selected aspirants,the Party cum give the stakeholders right to pick the Vice and the Secretaries. My dear people na so them take throway power give one elder for Sapele PDP Politics to choose who go be vice follow Hon. Chief Barr Omizu Ejaife Odebala. To cut the long story short,dis said elder for PDP just carry the rights and privilege of Okpe sons and Daughters,sell give none native for N10million. For this same battle between Hon. Felix Anirah and Hon. Monday Igbuya,report don also reach our studio say,dis same man wey be High Chief don still recieve the privilege to choose who go be the next House Of Assembly member cums 2015. Base on wetin we dey hear now,we dey hear say na the Former Hon. Julius Egbedi Vice nai dey give Hon. Felix Anirah hope thru Hon. Paulinus Akpeki,just becos say the new office wen Chief Akpeki get just now,say na thru Igbuya,he take get am. Atink unu remember say i tell unu say somebody chop N10million to sell Okpe chance to outsider during the Local Government election? That person na High Chief Paulinus Akpeki,and e do am,to make Sunny Aghimere the vice for the second time. Them give am the slot to provide vice,he sell that position to Hon. Micheal Diden a.k.a Ejele for N10million and Ejele cum give am to Hon. Mr Sunny Aghimere. My people dis na Paulinus Akpeki wey be d immediate past Commissioner For Housing. Potfolio wey get serious advantage to make better money and we all go testify say na Delta State nai get the most uncompleted project pass for the nation,and with that Hon. Paulinus Akpeki hand touch well well and with dis e new office,as Chief Of Defence for Government House,e don dey touch again and with dis e attitude,say e dey sell Okpe and positions for money wey nor reach Yankee guys and some even few Ghana Burgers take drink beer,nai dis chief dey fall,e hand dey put. Mainwhile rumours just dey spread follow the town,say them give Hon. Monday Igbuya certificate of return on Saturday night for Asaba,that na why the man loyalist nor dey shake body. But i stand dis morning to tell the entire people of this forum say na today go decide for us,becos the Party go give the rightful winner the Flag to contest,cums 2015 next year. Though right from on Sunday morning nai some other members of PDP and none PDP dey go Hon. Monday Igbuya house dey go congratulate am. I dey very disappointed with some of Hon. Monday Igbuya loyalist wey dey give reasons,say this Amukpe expansion na thru Hon. Monday Igbuya influence via Gov/NDDC office. If i may ask,na now day break? Wetin dey happen to the numerous Desopadec contracts wey dey ground since? Make we call spade a spade,i nor fit imagine the joy wey dey Sapele since on Saturday,becos the people don tire and dem dey clamour for change since. Now make i open my Ibeke mouth small. Na you Chief Paulinus Akpeki dey spoil Sapele and i put am to you say na you be Sapele developmental problem. You don sell the office of the Vice Chairman of Sapele Local Government to none Indigen and with that rubbish wey you do,e cum give birth to none Okpe also for Supervisory Councellors wey dem swear in also for Sapele Local Government Council wey bring in them Eric Mene and others. You Akpeki,you go fit go Warri North go collect Elected Office? You go fit buy slots for Warri South Local Government Politically? Unu go just dey let small money dey spoil unu names. See as Okpe Youths dey rove the streets dey find work for deir own soil,wey others for the make milk and honey. Most Okpe leaders prefer to dey helep outsiders than to helep deir fellow Okpe person to excel. I dey use dis update dey warn you Hon. Chief Paulinus Akpeki not to dey give dis HOUSE OF ASSEMBLY Candidates hope,dey expect say u go also sell the Victory give the highest bida. Report don reach me say na u dey give them hope,wey make dem dey announce different results for everywhere. I go personally keep quiet to wait for who go lift the flag before i go throw my comments. Gone are those days wey the few dey rich and the masses dey suffer. Gone are the days wey we nor dey get better Representatives for Elected offices. Sapele PDP norva get fractions for a very long time and the sins of some persons don dey hunt dem. Why Sapele go dey No Market and unu wen hold Public Offices nor fit act? Why e be say na Sapele Township Stadium go be the one among the few wey dey uncompleted? Why e be say na our State Library nai go dey abadoned? Why e be say our Constituency Projects fund we nor dey see am? Wetin dey happen to Roads project money for Sapele? Why e be say people wey suppose helep us caution BEDC nai pack go Line33 to keep us for Darkness? Unu remember my Dream? Uhmmmmmmm things don dey manifest from that Dream and i believe say dis na the beginning. I just dey laugh VANGUARD NEWSPAPER and all other Media Houses wey dey carry fake results. I don call for the Cancellation of Sapele Result,make dem do fresh election but if e nor work,then make unu announce unu Candidate wey go contest for next election cums 2015,becos dis na sign say other Parties don ready to pull stunt against PDP for this forth coming election and i dare to say this morning say,who the result or the candidate wey PDP pick nor go down well with,make the person and him fans cross carpet go test him Popularity for other Party. Na better Garri dey sell itself for where kpokpo dey. I Remain The Otota1 Of Sapele. The Urhukpe1 Of Okpe Kingdom. The Asamaigor1 Of Itsekiri Kingdom. The Eagle Eyes Of Delta State. God Bless Sapele. AKPEKI UPON ALL THE MARKET MONEY WEY U THIEF,U STILL DEY SELL OKPE CHILDREN POSITIONS. NOR TRY AM FOR THIS HOUSE OF ASSEMBLY BECOS NA GOD GO STRIKE YOU FALL. ARAMEGBO SAPELE/DELTA STATE MUST BETTER.
Posted on: Tue, 02 Dec 2014 06:54:33 +0000

Recently Viewed Topics




© 2015