SAPELE/DELTA STATE MUST BETTER. 04/07/2014. OKADA/BIKE - TopicsExpress



          

SAPELE/DELTA STATE MUST BETTER. 04/07/2014. OKADA/BIKE RIDERS. I nor even know where i from one start about this thing wen i wan talk so,becos i nor fit understand d rational behind am. The town don cast since from all ends as dem don succeed to demolish caravans and structures without alternative means for the people of Sapele to do deir businesses,yet rumour still dey fly follow air say Delta State Government still dey plan to stop formally Okada work for Sapele. My pipo.as day dey dark everyday wen pipo dey return back from work,na so i dey press phones dey waka dey contact all dis our Politicians to make sure say dem nor take us unaware again. As i dey go House near Old Eku Rd by Macpherson nai i throway call give the Commissioner Of Transport Hon. Ben Igbakpa to ask am well about this issue of State Govt to ban okada for Sapele. Na dere e cum explain to me say nor be say na Rumour,say the issue don dey ground since to Ban bike for Sapele,Udu and Aniocha South Local Government Areas. According to Honourable Ben Igbakpa wey be d Commissioner for Transport,e cum talk more say the State Government go distribute about 700 Keke Napep a.k.a UDUAGHAN HILUX, for the three 3 Local Government Areas wey e mention above. He say d reason of dis na to curb the excesses of Okada Criminal and Kidnapping and also e cum talk say e still helep to bring beauty for our Locality. E norva talk finish before i cut in,say abeg e do. Say as people dey happy for one side of matter na so some go dey frown for d other side. Becos some pipo dey now wey e be say na Okada deir Papa dey ride and na d Man be d kpuffkpuff,sori BREADWINNER for d family and the children must go School and dem must chop,so if dis kain thing cum join this wahala of demolition wey we norva fit come out from d shock so,say e nor go easy for d Residents of Sapele o. And also some bad roads many for Sapele wen Keke nor go fit ply e.g Akpo lane, Adeniyi rd,Ireto,Ojolu rd,Urhuakpa, Okrigbagada, some parts of Shell Rd like Mona side. etc My Honourable Commissioner cum think am well well,nai e talk say some lanes go fit get bike but Government nor wan use eyes see Bike for Major Roads at all. My people i nor wan talk now but i just say make i alert unu the waka wey dey ground first so dat we all go put heads together with our various suggestion before SAPELE TAFIA go make the public speech to the benefit of all. Mainwhile we don get signal before now say na dis month dem warn announce to ban the okada riders before now,but we dey fuel deir yanch to push the date forward first becos we need to recupurate for Sapele from dis unprepared demolition. COUNTDOWN TO SHUTDOWN PERMANENTLY. I REMAIN THE OTOTA1 OF SAPELE. THE URHUKPE1 OF OKPE KINGDOM. THE ASAMAIGOR1 OF ITSEKIRI KINGDOM. THE EAGLE EYES OF DELTA STATE. God Bless Sapele. SAPELE/DELTA STATE MUST BETTER.
Posted on: Fri, 04 Jul 2014 06:46:06 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015