SAPELE/DELTA STATE MUST BETTER. 07+07=14. Na for dis town - TopicsExpress



          

SAPELE/DELTA STATE MUST BETTER. 07+07=14. Na for dis town wen we dey wen we get many Okpe scholars and Political Leaders nai we norva see any benefit from any of the soil owners wey don sidon reason and profound quality programme wey go lead to the advancement of the pipo,wey dey reside for the community,also we norva get beta encouragement from any Okpe group educationally. I just sidon dey imagine say Itsekiri pipo nor dey Sapele,how Sapele for be. I be born Okpe Boy,but e dey pain me wen i dey see most of our Okpe leaders wey suppose do reasonable things to upgrade the Town,as dem dey show less interest to improve the well being of the pipo. Make we nor dey bias dis morning,becos truth dey bitter well well,but e must come out. Today i sidon for Asaboro Waterside dey throway greetings give Itsekiri pipo wey dey Sapele,most especially Hon. MIcheal Diden for e impact on the general Public,most especially with he zeal to empower pipo from diverse ethnicity,and for the support on the Educational sector. Many pipo go dey wonder why i dey praise Hon. Micheal Diden a.k.a Ejele today. Nor be say i dey praise am,but i wan draw unu mind go back to the early 60s wey Sapele produce the first Minister Of Finance. Na Itsekiri man and e name na Chief Festus Okotie-Eboh. If we look well,we go see say na dis man nai first inprint the name Sapele for Federal list of Ministers. Dis Man na strong lover of Education,and after e death we see e land mark achievement for Educational Sector,as e single handedly erect Ziks Grammar School and Okotie-Eboh Grammar School alongside other Churches and Schools wey e use influence the society and i believe say dis Schools wey Festus Okotie-Eboh put for ground don give birth to so many children including mysef. Though some Okpe old names do same and nai be Ayomanor Primary SChool,Ogodo Primary School,Okpe Grammar SCh,Orodje Grammar SChool and others,but the fact be say e nor easy for person to leave e community,cum join hands dey develop anoda Man land,and for that reason i deserve to salute am anywhere e dey. Them say Papa wey born children full ground and e nor get any meaningful one to take up from am,nai be say d Papa nor try at all. Na here Hon. Micheal Diden for cum on board so. As e like jaguda reach,e still know the value of Education and nor only like am for e self,e also want make others benefit from e wealth of knowledge and e throway e small coins to encourage the younger ones so dat,dem go see reasons to complete deir Educations. From no where e organize competition as part of e Church Anniversary and e give an to Eferiofe Education Services to cordinate for Sapele here again. The final of the competition dem hold am for Christ Foundation Ministry International, aka, Ejele Chapel, Sapele,and na Diden be d founder. The contest of the Final after many School don fall out during the process of the competition. Na the students of Sapele Okpe Grammar School and Excellence School of Science and Technology. Three students each nai represent each of the schools for the final. The competition as i talk before,na part of the programmes to mark the 5th anniversary of the Christ Foundation Ministry, a charity and evangelism outreach, wey get branches for Agbor, Ughelli, Koko and Warri. The finalists receive different prizes, including computers, laptops, Ipads, school bags, note books as well as cash prizes to the teachers. Diden, for e remark for the event wey witness top government officials, politicians and business executives, cum talk say the competition,him package am to encourage the students within Sapele and environs to study mathematics, wey he describe as the core subject to the study of science and related courses. “The competition according to am,na to ensure say the younger generation get assistance to attain high academic and professional standard, especially for the study of science and related courses, wey go better their lives and equip them for the greater task of self sustenance and entrepreneurial skill for the near future,” Dis na wetin man wey many of us dey write off talk to ginger the young coming ones and e also promise to train dem if dem pass deir Final SSCE exam well. Besides, Diden, wen be accomplish politician and notable philanthropist, talk say the competition dey in honour of late Okotie_Eboh, wey e agree with me say e dey among d first set of pipo wen put Sapele name for world map, according to Micheal Diden, e lament say “little or nothing about this town,dem don hear since the demise of Chief Okotie_Eboh.” “Charity begins at home. In the past we get a minister, Festus Okotie_Eboh, wey be from Sapele. From that time till now, we norva see anyother person wey don fit climb to the shoes of Late Festus Okotie-Eboh. Ejele decide to embark on this competition for people, wen believe in education to contest with others from the state and then, for Nigeria. The aim na to put Sapele for the world map again as it was in the past,either to raise young minds with sparkling future to compete wit deir mates nationally,so that from small dem go begin rub shoulders with people from State to Federal Level to gain easy attention on appointments and others,” he state. Diden cum assure us for studio say the competition go be annual contest, starting from the local level,State and national level. For a related development, Diden give out two cars,motorcycles and cash gifts to members of his church, to mark the 5th year Anniversary of the church. The cleric, while e dey present the gifts to d beneficiaries within the church premises, charge Christians to always assist and give alms to the less privilege members of the society as well as to love one another and eschew bitterness and violence. People wey follow mark and celebrate the 5th anniversary of the church with Diden and his wife, Evangelist Mary Diden, na former Minister of Niger Delta, Elder Godsday Orubebe, Founder of Christ Mercy Land Deliverance Ministry, owners of Mercy TV, Prophet Jeremiah Fufeyin, Ambassador Rex Justice of the United Nations, Chairman, Independent Petroleum Marketers of Nigeria (IPMAN), Chief Akpos Edafevwotu; Akulagba of Warri Kingdom, Chief Ayirimi Emami and former Chairman of Sapele LGA, Hon. Godwin Atose, among other dignitaries. The competition was designed for senior secondary students within d state. It dey expected to move from Sapele Local Government Area to other parts of the state and the country at large. Okpe Grammar school nai win the competition, among d 32 public and private schools wen participate from the Sapele region. A private school, Excellence School of Science and Technology, also from Sapele, came second while International High School came third. Ejele you try abeg. Make we nor dey judge book by e cover. If none indigin fit embark on dis great thing to uplift the name of our Locality,e good make we throway salute give am and encourage am to do more. Also i dey challenge Okpe people wey dey sell soso lands like people wey dey hungry to wake up and start to dey do meaningful thing to bring about the name of Sapele at the Federal Level. Also i challenge all unu wen dey build only Hotels to organize quality educational programmes to encourage the younger ones. Today wen i suppose Shutdown studio,i use am take salute Oga Micheal Diden and encourage am to do more. Also Ejele call me make we talk i nor dey gbadu ur jaguda doings over land issue,e get wetin i wan tell you and na u alone. If person try,e gud make dem celebrate d person,nor be only error we go dey point out. I Remain The Otota1 Of Sapele. The Urhukpe1 OF Okpe Kingdom. The Asamaigor1 Of Itsekiri KIngdom. The Eagle Eyes Of Delta State. If you know say Itsekiri People dey try for Sapele oya join me salute dem but if you say dem norva try oya give your reasons. Shutdown postpone till coming Monday permanently. God Bless Sapele. SAPELE/DELTA STATE MUST BETTER.
Posted on: Mon, 07 Jul 2014 07:03:38 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015