SAPELE/DELTA STATE MUST BETTER. 09/04/14. WITH GOD ALL - TopicsExpress



          

SAPELE/DELTA STATE MUST BETTER. 09/04/14. WITH GOD ALL THINGS ARE POSSIBLE. Some months back nai somebody draw our attention to one small Girl wey get accident break her spinal cord and the Father abadoned her for House due to say the Hospital wey dem first carry her go demand for N250,000 for the spinal cord operation but due to say the Father nor get then he cum carry d Girl go back to House. According to report the Girl nor dey fit dey feel her body,her legs and her foots,not to talk of to move am. When we dig ground to find d matter well,we cum realize say the father cum pay one old man money to dey cum rub the girl with native medicine. As a matter of fact dis Girl dey shit dey urinate for one place for months and she cum even develop bed sour. Just after all hopes don dey fail somebody cum report d issue give us via inbox,so we cum decide to helep her. So we cum contact d former Doctor wey commence d treatment he cum say d tin don pass wetin he go fit do. So we cum dey consult expert until we decide to use through the Local Government Health fund and department. Hon. Julius Egbedi cum promise to foot the bills and we cum make am public so everybody from dis forum cum THANK Hon. Julius Egbedi for accepting say he go foot d bills. My people na dat time Egbedi pick calls last from our studio. We throway several calls give dis unu caretaker committee chairman and he throway deaf ears give us. My people na person wey choose to commot from ring nai hands up for the fight. Na so the Girl cum dey ground as we cum dey profound solution and dey think of how to take her to specialist for the spinal cord operation. After all set and don we cum decide to see Dr James Efeturi wey get knowledge of dis kind issues. He cum advice us to go UBTH (University Of Benin Teaching Hospital). Dem nor dey go such place with ordinary pocket,so we cum decide to meet some persons thru phone calls and after the first post one of us here cum drive go d Girl place go comfirm and the person cum drom N50k as we need to go do X-ray to know howfar the dislocation don reach so dat the Medical Doctors go know what to do. But wen i discuss with DR JAMES EFETURI i cum see reasons why we need to take her to UBTH and do all the Test dere becos if we do dem here and still take her dere we go still spend more money to do the Test. After Hon. Julius Egbedi don fail to show concern to dis Girl we cum decide to look for take off money to assist dis Girl so dat dem fit carry her go UBTH becos delay is dangerous. Mr Solo Abeke wey promise to drop something cum fulfil part of e promise as one good samaritan throway N30K and anoda person also send in N100k wey we send 2 persons go collect and give the mother so dat dem fit hold reasonable amount of money go for d UBTH. We don sample idea from different source from UBTH and d random idea be say d operation go cost reach N500K to N600K. I tell d mother of the Girl to spend from the sundries of the N50K and make she keep the N100K as part payment for the operation. But at the end the money wey she spend remain we fit add am to join what ever amount of money we fit raise. When i look the way things dey go i just decide to unveil the account of the Girl wey she open with FIRST BANK so dat we fit atleast send in whatever we get to dis poor Girl and mother so dat the wickedness of Hon. Julius Egbedi wey think say without him dis Girl nor go waka or way want make d Girl die go know say we for dis forum nor dey play with ourselves and humanity. Today i dey urge everybody to wake up and respond to dis clarion call becos we nor pray make e be us tomorrow. Just as we dey helep dis JULIET EFETOBOR AFINOTAN na so God go use man take helep us. If we all wey dey active e.g like 300 persons pay atleast 1k each dat na N300K and i know say some persons go pay more dan dat as we from studio here done gada body to pay something very reasonable to lead by example. Make we nor look dis issue throway face oh,becos u neva can tell wetin fit bring salvation to ur door step. Dis na d Account details. NAME: JULIET EFETOBOR AFINOTAN. ACCOUNT NUMBER: 3069104801. BANK. FIRST BANK OF NIGERIA. My people dis nor je time to talk but act. As for me i believe say Juliet Efetobor go walk again and she go become great and show dis same kind gesture tomorrow to someone else. I dey beg all of us to respond as i dey monitor d inflow of the alert from my studio here to know if we dey progress or not. D drip wey doctor Adu fix for my hand don dey wan loose,make i rest first. I REMAIN THE OTOTA1 OF SAPELE. THE URHUKPE1 OF OKPE KINGDOM. THE ASAMAIGOR1 OF ITSEKIRI KINGDOM. THE EAGLE EYES OF DELTA STATE. God Bless Sapele. Hope say e good like dis? SAPELE/DELTA STATE MUST BETTER.
Posted on: Wed, 09 Apr 2014 05:43:55 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015