SAPELE/DELTA STATE MUST BETTER. 09/12/2014. MISS SAPELE - TopicsExpress



          

SAPELE/DELTA STATE MUST BETTER. 09/12/2014. MISS SAPELE PROGRAMME NA FAKE. I don talk am before say some persons from Oghara dey abuse the friendship wey Sapele dey offer them. We go remember say na Oga Hon. Ben Igbakpa wey be Oghara man,nai Government use take come demolish our structures illegally. Also wen e reach to Ban Okada,na still dis same Hon. Ben Igbakpa nai the Delta State Government still use against the poor masses wey nor fit afford to buy Tricycle. Just within the raining season wey just pass so. The bad work of Hon. Henry Ofa wey be the Commissioner for Desopadec wey dey represent Sapele/Okpe and Ethiope West do for Okoloko Bridge,distrupt Business activities within Sapele,to the extent say the bridge nor get access to dispose water wey dey gather from the rain water wey dey drop for the bridge,and e dey get serious Flood. Though i don complain tire and the persons incharge don call my phone,wit assurance say dem go fix the bridge well before the next Raining Season. The major issue today be say,we dey very receptive for Sapele and we dey make our environment dey very o.k for people to cum showcase deir talent and for sometime now,na one Mr. Jones be the organiser of Miss Sapele annually. For the year 2010 na one Babe wey dem dey call Miss Jane nai win the Event with controversies,and na for Richards Continental Hotel dem for organize the event. For 2011 dem hold the Event for White City and for the very first time, No controversy. But for 2012 dem cum bring the Event back to Richards Continental Hotel and na one Miss Laurina nai carry the Day,as na she win. For 2013 own wen dem organize for Richards Continental Hotel,na one Babe wey dem dey call Miss Amara wey cum from Ivory Coast and na Benin city she base,nai win the programme. Report don reach my desk since say this years own go still take place for Richards Continental Hotel by December 13th,but according to speculations,dem don shift the event cum on Friday,wey be 0n the 12th of this Month. The issue now be say,this Mr Jones na still from Oghara and rumour dey go on now,say one of the contestant MISS TREASURE wen don contest once for 2012,say dem don pencil down her name to win the programme. She don even dey tell people,say make dem cum watch her,say if she nor even fit answer the questions well,say she go still win the Car. She na former Miss Ethiope. She contest for 2012,and She bring her friend Miss Faith Amara Michaels from Benin to win the 2013 competition and before den,na so dem rake follow the Town say na dem go win the event,and really na Amara nai win the programme. Before then,my CCTV Camera catch up with the Organizers and these said Girls dey move from one Hotel to another. Wetin concern Participants and Hotels with Organizers? Now she dis Treasure don dey boast,say she dey come Sapele again to come collect her car,becos the winner first prize na Car. For all these favouritism arrangement, the organiser Mr. Jones dey clearly behind all the manipulations. As the Otota1 of Sapele,nor be my time nai one small Boy go dey deceive crowd dey fool us. Mr Jones i dey order you to stay clear from this year competition bcos e go bad well well if Miss Treasure win dis Friday after all this rakings. E go just clear say,na big waiyo unu dey do and i assure you and ur crew say, Sapele people dey wait patiently. With all these your wuruwuru wey u dey do so,e dey drag the name of Sapele down,also the name of the MD of Richards Continental Hotel,you dey drag am into mud,becos people go believe say,na you and am be the accomplice for all these arranged winnings. Now Mr Jones sidon make i talk to you,i know say u don dey binu,say i don burst ur bubbles,nor vex. (Madam bring One Can water for am wey block,to cool e mind). You see dis life na small shit dey stain yanch pass. God don dey use you dey do this thing to bring about positive and creative impact for our society,to the extent say most big names for our Society dey support you,even Seplat Company and at the end you dey go home with something reasonable. I go dey very disappointed in you,if you allow Devil use you,becos all thios Girls wey u dey organize dis programme for,nor be all be normal Human Beings. Some dey wash for Babalawo Houx,some dey use Magic Make-up, so nor feel say u be Superman. Just one Girl go bring all these ur good work down just now. When u decide to do dis kind work,u must cross ur heart and stay off Girls. If nor be say i be Woman,Girls for don pull dis page down,so copy sense and dey very careful,becos na ur doom u don dey near so. I nor go tolerate u if at the end of this very event we find out say the winner nor worth the Car. Hmmmm ask more about me from Sapele DPO and Navy Commandant. I nor dey take rubbish and i go throw my weight for your boat,to make sure say e sink,becos i nor dey take rubbish. Stay off ur Judges,also for transparency sake,i nor want make you see the Questions,wey the Judges go draft out for the contestants,becos time nor dey again,and if at all say,u don already give ur winner the answers,better draft new one after this post. The current miss Sapele na Faith Amara Michaels. She na Igbo Girl from Benin city,and na dis same Treasure wey unu don pencil down nai bring her come last year and you Mr Jones favour her to win the crown. Nor argue am becos if you do i go unleash all the evil things wey unu do in secret to prove my point wella becos many matter they for the head of the current Miss Sapele but i nor wan ruin her career. So make you Mr. Jones follow up with dis advise. I Remain The Otota1 Of Sapele. The Urhukpe1 Of Okpe Kingdom. The Asamaigor1 Of Itsekiri Kingdom. The Eagle Eyes Of Delta State. God Bless Sapele. How unu see this matter? SAPELE/DELTA STATE MUST BETTER.
Posted on: Tue, 09 Dec 2014 07:01:28 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015