SAPELE/DELTA STATE MUST BETTER. 10/12/2014. UPU MAKE UNU NOR - TopicsExpress



          

SAPELE/DELTA STATE MUST BETTER. 10/12/2014. UPU MAKE UNU NOR FALL URHOBO HAND POLITICALLY. Dis matter wen i wan put for ground dis morning i nor wan talk much and i want make we use our comments take talk weda e dey right for UPU wey be none Political body to endorse one particular Urhobo son,against the others wey dey vie for thesame position,as per been the Governor of the Delta State,within a Particular Party,wey be PDP,and as such dem nor interfer for other Party Primary Election to really show and display a parralel interest for the nation Urhobo. Abi e mean say UPU na PDP or wetin we wan hear na,na say UPU go cum convince all Urhobos Nation-Wide to vote for the next Urhobo Candidate. And when i sidon look the thing well,i cum see say,really PDP dare UPU to do anytin say their Majority Group voice,nor be Politics. Politics na game of Twist. PDP don see say,APC and LABOUR PARTY don already bring out two Urhobos. First this two Urhobos go share the Urhobo votes,then Delta North go pack am give deir most Privilege son,Delta South go share votes and we know say if Rigging go come out from any place at all na Delta South,wey dey always dey get Sokoto vote,so PDP get advantage dere,but depend on how INEC and Other Parties agent nor go sell deir right that day,because PDP dey believe in money. Then when you come Delta Central Urhobo go just dey disorganize because some Urhobos dey battle votes for Ovedje Ogboru for LABOUR PARTY,why the others dey vote for Otega for APC. I just keep quiet since becos dis UpU Chairman wey enter Leadership position after the death of my Classmate Aziza,nor just know anything. He dey lead like Agbero. Chief wey nor get the actual requirements of needed to Chiefs to testify say,e worthy to become Chief,but use money take buy the position. Carry e self enter UPU,buy e way again go become Vice Chairman,cum go dey privilege to succeed our illustrious son. Dis Chief Jo Omene just fall Urhobos hand,because if the Candidate of PDP cum finally win and Chief Joe Omene a.k.a Ejhorofo go mistake pronounce another Urhobo Candidate,say make all Urhobos vote for that person,nai be say UPU don dey do partial,becos u nor fit convince me say you go like one of your son pass the other. So with this update i dey call on UPU to remove their hand for Politics becos dis PDP wey unu shook unu legs put,just dey bring out unu secrets. Because wen dem nor make any Urhobo Minister for the Federation,unu nor do anything since,if not for my Late Friend Patrick Aziza,wey use e influence as past Major General,take break ASO ROCK code and after that unu come dey relevance small. Outside that achievement,wetin unu don do for the Urhobo Nation? Unu go sidon dey hold unneccessary meetings dey discuss issues wey nor concern the growth of the Youths and the Urhobo Nation,na to dey collect Envelops of Politicians,wey dey come visit unu. Unu know say na one Candidate unu wan flag oh,but unu go collect all the Aspirants Envelop first. You see wetin PDP do unu,dem just displace unu from Politics becos them make the thing very Transperent after dem don buy all the Delegates from behind. Abi unu wan tell me say the Delegates nor be Urhobos many pass? Na very simple calculation next time if unu wan really checkmate dis PDP wey dey power becos i don see say na Chief James Ibori nai be the Politic pen of Delta State. UPU for fight make APC produce Delta North candidate,then LABOUR go produce DELTA NORTH,since PDP don already talk say dem dey zone the thing go Delta North,so that if dem bold produce Delta North candidate,the other Parties go join them,share the Votes for that side and since we need change,we go vote in our choice,since we nor get Urhobo Candidates we go vote our choice squarely. But if PDP see say unu don checkmate them with deir Zoning,dem for break this deir chain,produce Urhobo Candidate,to pack the Sokoto vote for Delta Central,and by then that thing wey unu dey clamour for,don indirectly touch unu hand,to get person from the Urhobo Nation to Govern the State. Unu see as unu fall our hand? Unu dey feel say,the Urhobos wey unu get wey dey PDP go ever listen to unu advice? or cum vote against deir Party,becos unu pronounce? That na big lie. When Hon. Ben Igbakpa attend unu last general meeting,unu nor even fit ask am any meaningful thing,rather unu dey expect Envelope. Any big wings wey come unu gathering if e nor drop Drinks,na Envelope,unu nor know since say,unu dey fall unu hands oh. Abeg e make i quiet for here becos my sense wan finish now. I Remain The Otota1 Of Sapele. The Urhukpe1 Of Okpe Kingdom. The Asamaigor1 Of Itsekiri Kingdom. The Eagle Eyes Of Delta State. God Bless Sapele. Make we reason dis matter, UPU get right to interfer for Politics or Not and if dem go interfere why e be say na only PDP dem dey shook mouth put? SAPELE/DELTA STATE MUST BETTER.
Posted on: Wed, 10 Dec 2014 07:07:03 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015