SAPELE/DELTA STATE MUST BETTER 11/01/2015 USE - TopicsExpress



          

SAPELE/DELTA STATE MUST BETTER 11/01/2015 USE BRAIN Anytime election dey cum like this, I dey always dey remember Saturday Agbamu. My pipo, if you enter face book, na election issues you dey see pass. I beg, make we use brain. In politics, dem nor dey get permanent enemies. We fit get different views. We fit like different politicians. I beg, make unu nor take am personal. Nor use politics take enter relationship cum begin use am dey cause hatred among ourselves. In times like this, many politicians dey go extra mile to make dem dey at the favourable end. Some dey use money dey buy pipo conscience. Some dey go churches and mosques for prayers. And some dey land for babalawo shrine dey beg for spiritual powers. And in this spiritual powers, many ungodly sacrifices dey follow. My pipo, make unu dey at alert. And be on guard. Parents, hold your children close. Always monitor their movement. Na prayer wey I pray for church for Sapele nai be this PRAYER Any politician wey say na Sapele children head e go take do sacrifice for am to win election, na him go use e head take carry load wey e tie. Amen. Our children head nor go follow election rituals. Amen. Our youths heads nor go follow elections. Amen. And stray bullet nor go meet any one in the field of play. Amen. My pipo, make unu use unu brain o. As you dey talk about election for facebook, know say pipo wey know you reach house dey. So, talk about the issues and nor yab politicians. Dem say, small pikin dey plan to beat old man, but old man dey plan to kill am. Na your belle you know. Everything get rules. I fit don shut down studio befor election date nai make me say make I pass this info. As you carry your pvc go vote on that day, vote and leave there. Nor be one person get Nigeria. So, nor carry Nigeria or Delta state issue for head. If you die put for election matter, Delta state nor go observe public holiday for you. Nai be say, you be rat wey die for bush- Na only you throway yourself. My pipo, na wetin I get I dey give o. Youths, learn to be peaceful when unu dey go campaign. Nor kill your brother becos of one politician. Remember, the wealth of all the rich men in this country can not pay for the life of one poor man. Nor use gun take do election. Nor collect gun from politicians. Say no to election violence. Na only through this nai we go fit elect our leaders of choice. Once again, use your brain during this election. Mind wetin you post for facebook. Many eyes dey see am and many minds dey reason wetin dem go do you. Who get ear make e hear. I nor wan mourn any Sapele or Delta State person as a result of election violence. I don talk my own. If you like make you cut sense take. If you like, make you say e nor concern you. February 14 go give us scores. TEASER I believe say, many of us go church today. Oya, make unu answer this question God Jesus Holy Spirit All of them na the same person/Spirit or them be different entity? A. The same. B. Different. C. Different but exist as one. D. None of the above. NOTE: All of us dey different religion and some of us wey dey the same religion, we dey different denominations and that one lead to different beliefs. So, nor try to convince anybody make e believe your own. Talk your own and bounce. Have a wonderful Sunday. God Bless Sapele. I LOVE SAPELE. SAPELE/DELTA STATE MUST BETTER.
Posted on: Sun, 11 Jan 2015 14:36:42 +0000

Trending Topics



w a right-wing Govt. will change States, People
Le Métreur Vérificateur ( Economiste de Construction ) est

Recently Viewed Topics




© 2015