SAPELE/DELTA STATE MUST BETTER 11/07/2014 DIS LIFE My - TopicsExpress



          

SAPELE/DELTA STATE MUST BETTER 11/07/2014 DIS LIFE My pipo, anytime time when person die, make we dey always dey check our life like wetin oyibo call sober reflection. Make we dey look our life and use am take compare who don die. The greatest gift for this world na life. Dem nor dey buy life. Dem nor dey rent am. This life wey everybody get nor get part 2. Na just one season. If you die, that na the end of Solomon Grundy. If we get this for mind, we go always give God thanks. Nothing dey dis life. If you get millions or your name na billion sef, na one head you still get. Now, take the life of our own sister, friend and pikin, late Kefee Don-Mommoh for example. All the money wey she make, All the fame wey she get and all the enjoyment wey she enjoy, na six feet all for end. E nor get one thing wey she use her own money take buy wey she carry enter grave. The casket wey dem put her, nor be she get the money wey dem take buy am. The burial clothes, nor be she buy am. Now, wetin she come work for here on earth? Everything is vanity. The only reason I go cry for somebody wey die na the impact wey dat person make for life. Now, look your life and use your mind take calculate all the good impact your life and wealth don make for pipo life. All the money we dey make, e good make we use am take sow seed and bless pipo becos if we die, na dis pipo go carry us go bury. For your family, how many pipo you dey help? Among your friends, how many pipo you don bless financially and with your position? For where you dey worship, how many lives you don change with your wealth? God bless you make you for bless others. That gift, that talent and that money wey God give you, na the way you dey use am nai matters. We go surely die. Use your tongue count your teeth. Be nice to pipo. Life dey very short. Who you be? Business person? Trader? Worker? Civil servant? Dancer? Sports man? Musician? MC? Pastor? Etc, As long as you be human being, show love to pipo. You must not get all the money wey dey this life befor you go fit bless somebody. And you wey dem dey bless, still bless others. Food wey belle dey store, na mouth e dey pass enter. We all are connected. Show love when you still get the opportunity as you dey alive. Any good wey you wan do, nor postpone am. Grave don swallow many unfulfilled promises. I don talk am befor, many of our Athletes like Blessing Okagbare, how many Sapele pipo unu fit boast say unu don sponsor go far? See Bovi wey be comedian, na through RMD nai e take dey where e dey. All the money wey dey dis world nor go fit satisfy anyone, but the simple good wey you go do for someone, go give you deep satisfaction. Kefee don die, how many pipo go fit stand say her songs give dem hope and draw dem to God? How many pipo go fit weep say the person wey help dem achieve great things nai don die so? How many pipo go fit wish say suppose death dey send letter give person before e come, na dem for collect Kefee own? When, even one person fit stand to collect bullet for your sake, nai be say you are good. Let us try to write our names for pipo heart so that when we die, millions of pipo go continue to serve God for our sake. I cry for Kefee becos she be Sapele pikin. Death nor dey respect anybody. So, make we live well. Nor be how you die or when you die nai matter, but wetin you do with your life to make God smile for the few years you spend for this world nai count. Nothing dey dis life o. So, make we get sense. God Bless Sapele. SAPELE/DELTA STATE MUST BETTER.
Posted on: Fri, 11 Jul 2014 14:21:15 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015