SAPELE/DELTA STATE MUST BETTER 13/09/2014 WE RUN TO GODS - TopicsExpress



          

SAPELE/DELTA STATE MUST BETTER 13/09/2014 WE RUN TO GODS MERCY If you look how the trouble for this life take dey come, nobody for dey alive. Na hanging things for be our slogan becos everybody nai go dey buy rope to commit suicide. When God put Adam and Eve for the garden of Eden, He give dem assignment. That is, to maintain the Garden. That task nor easy o. If you doubt me, go ask commercial farmers wey dey Jesse. My pipo, right from the very day we cry enter this world, na from one battle to another. Even when we don die, our dead body go still face another trouble from family hands base on how dem go bury we. Many times, we go sit down dey analyse our lives. Na from there we dey count many wahala wey dey fight against our happiness. Good jobs nor dey. Sickness dey ravage us. Mortality rate dey high. Life span don reduce well well. Rape dey increase. Divorce case dey many. Armed men dey curtail our peace. How many we fit mention? Na childlessness? Na impotency? Na kidnap? Na assassination? Na insecurity abi na spiritual problem? Most times when we dey think about these problems, we go dey ask where is God? Yes, we go dey confused sotay befor we go ask whether God still care nor be our clear eye. if we say make we live according to the good ways of life, that is, to be Honest, Selfless, Kind, Righteous, Diligent, Faithful, And patient, We go still discover say problems still dey knock on our door. Good name better pass pounds and dollars. That na sure my pipo. You do good, you go die. You do bad you go die. And sometimes, wicked pipo dey last pass good pipo. Na true. But make we listen. Nor be to live a million years without good name but na to live a very exemplary life nai matters. Everything for this life wey we go achieve na vanity. The riches, The gold, The pounds and dollars, The titles, And even the wealth. As soon as we die, everything don become another person own. So, why must we kill to achieve some things? Why we go make our lives to become devil tools becos we dey find job. Some pipo don surrender their soul to devil just becos dem dey find money, pikin, position and even title. E nor good. If you collect plate of rice from devil hand, na your pot of soup e go carry. If devil give you a cup of water na your well wey you suffer dig nai e go close. No matter the trouble you dey face, try to have faith in God. E nor get anything God nor go fit do. Just remain patient. Remember say, God nai be the potter and na we be the clay. Inside every great house, dem get vessels of gold and vessels of silver. For our body, we get head, we get eye we get legs and so on and so forth. Some pipo dey, na to be the head nai God create dem. No matter the trouble dem go face, dem must surely be the head last last. Some na eye. So, if you nor know your purpose for life, you go work and hussle in vain. Some pipo, God create dem to be followers. God create some to be advisers. And God create some to be servants. If you strive to become wetin God nor create you for, na double wahala for deady body. My pipo, if you dey travel to your dream and you nor see any trouble for your way, you dey the wrong lane. So trouble na normal thing. Life nor be fried rice. And no matter the thing you dey find for life, nor find am go babalawo place. Dem fit give you but you go pay dearly for am,becos Devil dey binu for ur progress. Believe in God. When trouble dey pursue you, run enter Gods grace. Anything you dey find, go on your knees and ask God to give you. Pray, fast and continue to be expectant. Those wey trust God, nor dey dey disappointed. Let us pray. Our God wey dey for heaven, na your children dey pray so. Today wey be Saturday, many of our young boys and girls dey cry as others dey marry. We dey beg you make you answer our prayers. Those wey need marriage partners, answer us. Those wey need admission for school, answer us too. Baba in heaven, many of us dey look for good job, pikin, healing, peace for marriage, steady relationship, good contracts, family unity, good friends, good health and security, deliverance and visa to travel abroad. Many of us dey epexct justice from the law, while some dey wait for your grace to help dem becos dem make mistakes. Baba God, we bring all this petition befor you. E nor get who go fit answer dem. Na you be the only living God wey we fit trust. Answer our prayers. Nor look our actions. Nor consider our thoughts. Who we be befor you? Like ant befor elephant. As we drop all our cares for your feet, we believe say we don trade dem for positive result. Thank you becos you don answer our prayers. May we be alive to dance to the new song wey you go play for us all for this forum, for Sapele and for our dearly beloved Delta state. Amen. God Bless Sapele. I LOVE SAPELE. SAPELE/DELTS STATE MUST BETTER.
Posted on: Sat, 13 Sep 2014 14:52:57 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015