SAPELE/DELTA STATE MUST BETTER. 23/12/2014. PEOPLE - TopicsExpress



          

SAPELE/DELTA STATE MUST BETTER. 23/12/2014. PEOPLE DEMOCRATIC PARTY (PDP) MAKE UNU SHOW UNU REPORT CARD! When School teaching calendar reach one stage,children or students dey show deir score card. This score card nor be to kill the children but na to access the abilities and knowledge of the kids. Many parents nor dey use dis report card dey play,becos nai dey let dem know the kind brain deir children get. Today i nor wan too talk becos e dey very annoying say people wey we put for office to lead the local Government nor dey think of the masses and dem hold us the right,to show us deir Report Card,so dat we fit access them from deir performances. Make i nor too talk make tori nor long. Sapele na one of the Industrialized growing Towns for Nigeria with other towns like; Lagos. Calabar. Kano. Abeokuta. etc Today Sapele wey get facilities wey dey attract foreigners and non indigens don turn to one old peaceful village. Atleast aside Infrastructural Development,the minds of d people suppose dey well develop thru concrete development of the mind. The only thing wen any Government hold e people na,Socio-economic, political and educational programmes and also economic developmental projects wey dem execute,within responsible and definately time,but in all Sapele dey learn becos na confirm matter say from 1991 wen IBB create Delta State,Sapele nor just get simple level. Make i talk dis thing dis morning say the way and manner wey the Government use take dey abandon projects for Sapele don dey push the masses to the walls and very soon the masses go soon turn face the political Governmental officers. Na since 1946 nai Sapele don dey reign for the federation. Today Sapele be like one weak deserted village,crespuscular landlocked dungeon. Ever since dem create Delta State August 27th 1991 wetin be the project wey Sapele don benefit? I just dey look the Government dey laugh becos if you throw something go up,it must come down back. Other towns nor dey reason Roads again but Sapele for Delta State nai get series of bad spots wey need repairs but the Government feel say we nor get right to ask dem for deir report cards. This na Xmas season wey Sapele born home and abroad dey cum back home to cum celebrate Xmas with deir people. Na big shame say Adeola Road by New Road still dey in a pity state. Boyo Road by Market na apology. Urhuakpa village wey get oil wen Seplat from dey drill oil nor get Light,Road,Health Center,the School wen Igbuya manage build nor get accessable road. Ugberikoko na talk of neglect,becos the road from Gana to our Governor Village nor even get drainage not to talk of wideness. I nor fit talk say i dey regret for Sapele but make we sidon talk truth Sapele Stadium nor get single hope becos dem just dey use d stadium as ATM take dey thief. See Market. Dis na the 10th year wey our people dey suffer dey buy and sell along road. If we dey talk make we know say Sapele nor get levels again becos the leaders wey we get nor get single conscience to upgrade the town. I go market on sunday go buy Eye glass for my twins nai i see say we for Sapele dey really dey suffer. Which of the town names above we fit use compare Sapele? Sapele nor even be like where get King. I tire to talk for Sapele matter becos e don dey near wen the poor people go begin speak d language wey d rich go understand. I Remain The Otota1 Of Sapele. The Urhukpe1 Of Okpe Kingdom. The Asamaigor1 Of Itsekiri Kingdom. The Eagle Eyes Of Delta State. God Bless Sapele. This Picture na people wey dey sell for Road for Market. How long we go continue like this? SAPELE/DELTA STATE MUST BETTER.
Posted on: Tue, 23 Dec 2014 07:24:44 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015