SAPELE/DELTA STATE MUST BETTER. 25/11/2014. HOUSE OF REP - TopicsExpress



          

SAPELE/DELTA STATE MUST BETTER. 25/11/2014. HOUSE OF REP MONEY DON FINISH JUST NOW MY GOD. Good name better pass wealth. Back tire nor go fit overtake front tire. I dey talk am here everyday say most of our politicians go Zero just now if God turn the Table by 2015. How long we go sidon dey look bad things dey happen and we nor go fit address am? For where i dey fear don die and the battle to make Sapele and Delta State better don commence and i dare anybody wey know say if na Sapele reform e wan sidon press,then make e know say i must disgrace am wella. First make i let unu for dis forum know say this company wey dem dey call BEDC wey dey incharge of our consumable electricity na almost and infact na Private firm and as such any private firm,the major reason of the business na to make profit more than to satisfy it buyers. This BEDC people don too take us for Sapele as fools. I go let unu know say na the Company right to produce Transformers,Cables,Fuse,Poles and any other thing wey go make dem fit sell deir product to the consumers,but greed don eat so much into dem becos our Leaders,most especially our Community Leaders nor dey vibrant enough to helep caution dis electricity stealing. Now make i narrow my post to some areas wey norva get and use Government light for months for this Sapele and this useless company called BEDC nor care to intervene,then if i may ask,who dem cum dey serve if the common man within the town nor fit get Electricity to use for dis 21st Century? If person build House finish and e find out say Ligh norva reach where e build Houx reach,he suppose contact BEDC with written letter and specify the number of Houses and the kind of Houses to enable BEDC know d kind of Transformer to bring and connect to them before billing go start. BEDC own nor be like that. Them go force you to buy Poles wey go draw the light to your House,then compare you to buy Transformer from them with wires. Then the consumers go cum still pay dem Labour charges again. This na rubbish and crocro stealing. If the person wan change location atink e go carry the Transformer put for head? Oh my God. Sapele Leaders too weak and e dey pain me. So many Transformers for Sapele don pack down and BEDC nor dey even dey think of repairs,rather dem dey think more to extract money from the consumers. To tell unu say our leaders really weak make i use former House Of Representative member of Sapele take do case study. The area wey Hon. Joyce Overah dey stay for Shell Road BEDC forgot the people wey dey use the Transformer wey Overah dey use for two weeks and the stupid BEDC throway sky rocket bill give the people about 3months now,if the area people nor fit call BEDC to order,the person of Hon. Joyce Overah wey serve for lower House for Abuja suppose know e left from e right to know say,e get right to sue the company if they refuse to reconcile the bill and restore d light but he keep quiet. Before i know wetin dey happen again BEDC with some ofbthe area people for Shell Road cum ask the people to pay N16,500 for each compound with Tenant and before then dem don collect N3,500 from each compound wey dem nor fit give account of. The thing wey cum baffle me be say,the people buy pole,buy wire,pay N35,500 for New House yet,BEDC and some area thieves still dey ask more money from them. If Hon. Joyce Overah know wetin e go do for House Of Rep BEDC nor go dey oppress the people of Shell Road for e present. When i look this issue well,i cum notice say nor be only BEDC dey oppress the people. Some useless people wey dem assign to dey collect dis money,wey be men and Landlords na big thieves dem be. The issue don burst for shell road now almost after SEPLAT say Overah light committee don eat N400,000 wen the area people ignorantly gada,say make dem use pay make dem take install the New Transformer wey dey near them,so that dem go get light. These people just dey eat money anyhow from the Landlords and the Tenants and Landlords nor dey fit do them anything. Them hold one meeting on this issue some days back and BEDC people even dey around and BEDC people cum dey threaten dem say if everybody for the area nor pay their light bill finish, them nor go power the Transformer. First make i tell unu wey dey BEDC for Sapele say unu nor be God,na dis issue of Monopoly product nai dey spoil dis light issue. This people don buy Poles,buy Transformers and pay for wires yet unu nor wan power the Transformer for dem to use. Unu sure say unu value unu jobs becos na to write and paste unu names follow Nigeria Dailies nai be my next target so that i go use unu as scape goat for others to know say even if our leaders nor wan get sense to helep caution unu,then unu go know say SAPELE TAFIA and the people dey Sapele and Delta State. I give unu now till dis weekend to go restore this people light or else WAR START. Light wey people nor see nai unu dey make mouth say dem must pay put. O.k if nor be thief dey worry unu why unu nor gree distribute PRE-PAID METERS? Aranmegbo for all unu head. Make dis week end first and light nor dey dat side unu go caugh out blood for dis town. Enough is Enough on unu matters. As for you Overah u don sell all ur land space wey u use our money buy for shell road take dey run dey carry kola follow Igbuya for all e campaign. I just dey sorry for you,becos na u instal this committee wey nor fit give account of N400,000,if anything happen to that money i go personally rubbish you for dis town till u and the thieves caugh that money come out. Just use dis update call for meeting and invite all stakeholders to assemble make unu resolve dis issue. The next time u go see ur name for dis issue again na Nigeria Dailies. I REST MY CASE AND I DEY WARN SAPELE BEDC TO WAKE UP OR ELSE SAPELE GO SOON DECLARE SAY WE NOR WANT BEDC AGAIN. I Remain The Otota1 Of Sapele. The Urhukpe1 Okpe Kingdom. The Asamaigor1 Of Itsekiri Kingdom. The Eagle Eyes Of Delta State. God Bless Sapele. NEPA,PHCN,BEDC and GENERATOR which one better pass? SAPELE/DELTA STATE MUST BETTER.
Posted on: Tue, 25 Nov 2014 07:04:18 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015