SAPELE/DELTA STATE MUST BETTER. 26/01/2015. DIS NA WHERE I - TopicsExpress



          

SAPELE/DELTA STATE MUST BETTER. 26/01/2015. DIS NA WHERE I FOR HATE OPPOSITION FOR SAPELE POLITICS! Papa wen talk say,e wan change the standard and ways wen e family dey leave,suppose change himself first. When i sidon look the Individuals wey dey contest for SAPELE HOUSE OF ASSEMBLY. Abeg unu wen be APC for dis room,make unu nor attack dis post if unu nor dey basis or good reason to talk. I nor dey any Political Party and in all fairness election na individual basis. The reason wen make me nor dey easily take side,most especially to support the opposition candidates,na becos the people wen dey occupy the opposition most especially for Delta State and Sapele in particular. Na dis town nai we all dey,we throway our support for dis MR CYRIL ABEYE OGODO against Hon. Monday Igbuya,dis CYRIL pass our back go collect SACK of money from Hon. Monday Igbuya against our mandate. Becos na him be the Principal Officer against the verdict,e refused to challenge the wrong result wey dem announce,and we wen dey ground wen use chest collect Bullets and use our Odechi from God take wave Cutlass cut throway nor fit talk becos you be Don for one side. The people of Sapele cum also dey rally follow you atleast where other brains refused to act,u cum also switch enter APC,collect better office,as the vice chairman for Delta State. To open ur stupidity well make the public really know how you be,you cum use Mr Member take go buy SAPELE HOUSE OF ASSEMBLY TICKET and na your name nai dey the receipt. When fire dey catch for PDP SAPELE HOUSE OF ASSEMBLY ticket issue,you dey busy dey chop snail and wine dey waka,becos you know say na pure business you dey use ur Ticket dey do. When Igbuya take the ticket,nai you CYRIL begin contact the losers to cum buy ur ticket to take fight the opposition. I dey aware say Hon. Godwin Atose leave you CYRIL and OTEGA for Warri after unu indicate plans to sell the ticket for am,but Atose play unu Maradona skill becos him na born politician. After many try and error,unu come invite Felix Anirah wen drop large portion of amount give the APC Delta State chapter. Intel confirm the transaction to be N25Million and about N1.8Million touch CYRIL hand thru d front door,na only God nai know amuch e collect via back door. Unu see the reason why i dey vex with opposition for Sapele. This na Party wen dey project change. Just becos dis Hon. Felix Anirah don spend over N45Million take loose the PDP Ticket for House Of Assembly,e cum run pass back go APC over night say e must win. With the way and manner wen all dis men dey desperately dey spend money,we sure say if any of them win,say dem go do anything for Sapele? This Hon. Felix Anirah wen dey relax for the Government since undermining say e nor dey contest. You build walls as High Chief from Palace and passed Local Government Chairman take gather supporters full body. Among all the stakeholders for PDP na you gain pass and na you Hon. Felix Anirah nai betray him Loyalist wen make fight almost dey the Town just now. Felix listen to me. You purposely buy Chairmanship Ticket for your wife against ur own Boy Hon. Godwin Atose,instead of you to join Atose work base on say na ur Boy. When ur wife lost out for the race,u cum also bold buy Ticket to challenge Igbuya wen you for don nack down since,but becos of greed you pack face. Na you claim Federal Government support to pick the House Of Assembly Ticket for PDP and after you lost,u cum run go APC. Bad wine inside good bottle. Not until we do total overhauling within dis opposition Party Executives and deir Candidates i stand to be corrected,all of dem na one. Dis APC people norva enter Government to take power,dem say dem wan fight corruption and their inputs or method of government within deir Party dey fraudulent. Wetin unu wan tell us for Sapele,say when IGBUYA,ANIRAH AND LUCKY dey battle the primary election result within PDP,say APC and LABOUR nor get Aspirants wey buy the Parties House Of Assembly Ticket? Why unu dey fool unu selves. Unu just dey fool the general public,becos with dis unu attitude i doubt credibility from the candidates and the Parties. I therefore refuse to support anybody becos the three candidates hands nor clean. I nor get much to talk about this morning becos i dey vex for the way opposition parties dey sell deir tickets to same PDP wen don dey chop our money and marginalize us against our rights. I Remain The Otota1 Of Sapele. The Urhukpe1 Of Okpe Kingdom. The Asamaigor1 Of Itsekiri Kingdom. The Eagle Eyes Of Delta State. God Bless Sapele. CYRIL OGODO DO BAD OR E NOR DO BAD? APC DEY WRONG TO SELL THEIR TICKET,THEN THEM CUM BREAK THE PERSON WEN DEY DERE BEFORE MONEY TO QUIET? SAPELE/DELTA STATE MUST BETTER.
Posted on: Mon, 26 Jan 2015 07:18:20 +0000

Trending Topics



tyle="min-height:30px;">
Bryan K Monahan 13 hrs · I now interrupt my usual rants to
Case Studies: Emergency Care And Transportation Of The Sick And
I love that people think I am crazy because I tell them 90% of the

Recently Viewed Topics




© 2015