SAPELE/DELTA STATE MUST BETTER 27/01/2015 I NOR GO EVER - TopicsExpress



          

SAPELE/DELTA STATE MUST BETTER 27/01/2015 I NOR GO EVER CARRY MY DEATH LETTER GO GIVE MY ENEMY TO KILL ME. AMEN. When the King say make e come outside cum take fresh air, e stand for the top of e palace, e gold crown dey e head as he dey around dey admire the beauty of e Kingdom. From far nai e site one fine lady wey dey baff. He cum send one of e servants make e go call the fine woman come. Apart from God, the fear of a woman is the beginning of get sense. The King look this woman face, he swallow spit. Nai e tell her say na she be the finest thing e don ever see with e eyes. Whether she don marry? She say yes. For the woman eyes, water don dey gather becos e be like say she dey fall small small for the king. The king cum put hand for her shoulder nai e breathe upon her face. She closed her eyes as her legs don start to shake. Her ears stand to hear wetin wan come out from the King mouth again when she say My Lord, I am married and I go always love my husband Nai be bombshell wey the King drop You sure say you love your husband? The lady turn her face away nai she say Na the duty of a woman to return the love her husband get for her Whether na charm the King use o or the lady want am o, I nor know. The king cum hold her, turn her around, befor she blink eyes two times, the king lips don plaster her own. After the kisschat, the king cum ask her Who be your hussy sef? Na there she for say her hussy na soldier for the King army. And e follow the other soldiers go fight. The king nor talk. After that day, na steady doking. One morning, the lady cum come meet the King nai she burst the code My Lord, yawa don gas o The King nor talk. I miss my period. So I get belle. And you know say my hussy still dey battle field. Na only you nai dey shine my congo since. If my hussy come back to see say I get belle, na double wahala for deady body o The king, being person wey wise pass tortoise but e nor dey fit see e ear, e cum say make the lady nor worry. Say e go send for the husband. And make she make sure say the husband sleep with her befor the hussy go go back to war. From there, the hussy go feel say na e doke he wife get belle. Where one sin don start to grow, many other sins go follow up if you nor root the first sin throway. True to his words, the king cum send foot soldier go bring the lady husband cum. E cum tell the young man make e go house go enjoy with e wife befor e go back to battle front. But the young man nor go fit meet woman as that one dey against the ethics of army. And e nor go fit sleep for the comfort of he home when he fellow soldiers dey sleep for bush. The king nor talk. E leave am nai e tell am say for evening, make e come say e want make the soldier follow am eat. That evening, he cum pour drink for am make e for high so that e go go house go sleep. But the soldier just sleep for the king front door. E nor go house. In the morning, in a bid for the king nor to let pipo know e evil plan, e cum write letter. E give the soldier make e give e commandant for battle. My pipo, the soldier cum carry letter go their camp for battle go give e commandant. My pipo, the king look e soldier, nai e give am hand band as gift tell am say na for e brevity and love for e country. The soldier accept the band as a gift when the giver know say na death gift. Human heart! The commandant open the letter nai e read an for e mind: Commandant, send the bearer of this letter to the enemy camp wey dey fearful pass. And retreat your man so that dem go kill am for the battle there. Obey and nor ask question. I have spoken. The king The commandant look the soldier na e smile. As commanded, he order the troop go the deadliest of their enemy camp. Na there dem for fall the soldier. The soldier join other soldiers dey fight for e country. Befor e know, all e men don disappear leave am. Na so dem surround am. The more e dey, the more the enemies dey many. Na so e fight till e strength fade away. At last, dem cum fall am. This life! Rat wey dey inside house destroy pass the one wey dey outside. Nor follow anybody fight any course with one mind becos you nor go know when those wey stand for the same line with you change their mind. When news blow cum say the soldier don fall, the king mind cum rest. The soldier wife cry for something. After she mourn finish, na steady poking with the king... The first pikin wey dem born die. But the second wan nai stay. In the middle of e evil lifestyle, one man cum come meet the king for palace. E tell the king a short story. E get one poor man wey dey train only one sheep. And another rich man wey get flock abi na herds dem dey call am. When the rich man get visitor one day, e cum order make dem kill the poor man only sheep to take entertain the visitor. Dem true true kill am. The poor man cum dey cry E norva talk the story finish, the king don vex Who be that wicked and evil rich man? Go bring am make I kill am. He must die The man look the king nai e say My Lord, you are the one Cold catch the king when the man tell am say everything wey you need, God give you. If e get any other thing wey you need, ask God and e go give you. But you kill a poor man to collect wetin he get Shame catch the king. My pipo, when I go through this story over and over again, my heart fail me as I begin pray for myself Baba God, nor let my loyalty to any man or king, politician, father, friend, bring me death. Amen. Make I nor use my hand take deliver letter wey go instruct any man to kill me. Amen. And anything wey I get when somebody wan take by force, baba, nor let my life follow that thing in Jesus name. Amen. Oya, open your mouth and pray for yourself and your loved ones. My pipo, for yesterday TEASER, na farmers government suppose give more attention pass doctors and teachers. We can stay without teachers and doctors but not without farmers. Full stop. TEASER From the story above, Who be A. The king? B. The Soldier? C. The Lady? D. The Commandant? E. The man wey cum tell the king that short story? F. And the name of the second pikin wey the king and the lady born? Make I know pipo wey dey read better book for this forum. May our hands nor carry letter of death. Amen. God Bless Sapele. I LOVE SAPELE. SAPELE/DELTA STATE MUST BETTER.
Posted on: Tue, 27 Jan 2015 14:31:26 +0000

Trending Topics



>
The Alberta Veterinary Medical Association (ABVMA) had released a
CITIZENS’RIGHTS TO PRIVACY Electronic Surveillance --
Good evening Mr. and Mrs. Here is my email address:
Prepac Cherry Triple Width Wall Media (DVD,CD,Games) Storage
Miss Great Britain Grace Levy is coming in the competition for the
(With Factory Installed Rack) Oldsmobile Silhouette 2003-2004

Recently Viewed Topics




© 2015