SAPELE/DELTA STATE MUST BETTER. 28/05/2014. WETIN I DEY HEAR - TopicsExpress



          

SAPELE/DELTA STATE MUST BETTER. 28/05/2014. WETIN I DEY HEAR SO? I don see am say many people dey wan full dem selves follow Sapele,all in the name of greed and i stand as the Iroko of Sapele to nack any winch fall wey wan spoil or take Sapele back,becos enough is enough and with the strong Bible wey dey my hand and the sword i go cut bad Politicians down wey wan spoil this town Sapele again. O.k make i ask all unu Hon. Monday Igbuya,Hon. Austine Ayemidejor,Hon. Paulinus Akpeki and others including you wit Lion Heart Ejele say unu nor dey travel go other States,abi unu nor dey see as people dey develop deir localities? Why e be say Sapele own cum different and unu just fold hand dey do competition of who thief State money pass. Then when Election reach unu go just dey impose Leaders due to favourism and loyalty,without vision or mind to develop the Locality. I dey vex for all unu and today i open my mouth declare war to unu selfish deeds. Because as the Bible talk am about the prodigal son wey e father welcome back after e philandering elsewhere amid much pomp and fanfare, Delta State Peoples Democratic Party unu recently and warmly welcome back Hon Omizu Ejaife Odebala,wey be two-time House of Assembly member and commissioner for Delta State wey represent Sapele. Unu organize welcoming committee wey include Chief Ighoyota Amori, Senior Political Adviser to Delta State Governor, Mr. Christian Onogba, commissioner BRACED Commission/NDDC Delta State, Hon. Monday Igbuya, member of Delta State House of Assembly and Hon David O. Oghenekevwe, PDP chairman Sapele local government and other stalwarts to grace the occasiion and na dis same people nai negotiate e come back to unu Party PDP. The big names wen i mention for above come describe Hon. Odebala as a great asset to the party for Sapele local government area and Delta State in particular. Odebala wey defect back to PDP from the Labour Party where he for contest the Delta State House of Assembly position for the third time but lost to Chief M.O. Igbuya PDP. Chief Igbuya for e remarks recount their early days for PDP, him say he feel greatly disturb the day Odebala left the party to contest under the Labour Party becos of e wealth of grassroot knowledge. He cum also recognized Odebala’s pedigree as a grassroots mobiliser wey dey use him time and resources take dey promote the party for Sapele, Delta and Nigeria at large. I quote Hon. Monday Igbuya statement dat day, He said that having x-rayed the period Ejaife derailed with his followers to Labour Party, he discovered that except Odebala returns to his original PDP family and background, it would be difficult to get a break through. Hence, nai make am decide to approach Odebala as a brother, to appeal to am to get change of mind and say make e come back to the PDP family where he belong to. I laugh throway phone for soup. Make we nor look for long stick to kill the snake,make we talk am as e be. Wetin Odebala don do for Ward4 wey be e ward? Nothing. I hate lie,na from Sapele here nai Ejaife Odebala for win House Of Assembly two times and as far as we dey concern for Sapele here,e nor do anything,i mean any project for Ward4 not to talk of Sapele as a whole. Instead i remember the following things wen e do like; *He sign letter to impeach the then Governor James Onanefe Ibori. *He sign letter to sell some parts of Sapele (Ogwanja and Ugbeyiyi) to Warri North. *He sign letter to move Poly to other places and e nor ever fit fight make any School come Sapele. *He personally divert all our allocations to build one of the best Hotel for Asaba. *He nor ever monitor Sapele main market and Stadium project to finish. *He Buy motor take empower e boys and collect all the motor back. etc Now make unu tell me wetin Sapele do dis man. I don dey see am say na the initial arrangement between Hon. Monday Igbuya and e members na to bring back Odebala to the Party to come sidon as Sapele Local Government Chairman come October 25th Election. Make we put friendship for one corner make we access dis man well,how we fit take trust dis man wey sidon for House Of Assembly for 2years and Commissioner for almost 3years to come perform for Local Government Chairman? Person wey go House Of Assembly nor be up e suppose dey go if to say e lead well? Why him come dey fall back to Local Government? I sometimes dey shame for the way and manner wey our people dey react to offices. As far as i dey concern Hon. Ejaife Odebala don fail 1st, 2nd and 3rd time. So we nor get space for such person for Sapele again. Sapele don outgrown selfish leaders and make i tell unu. Atink unu see as Governor dey do us,say we nor vote for am? Dat na to tell unu say the pipo of Sapele don tire and dem want change by all means becos even if na Rat be unu opposition,dem ready to vote the Rat just becos dem want Change. So unu need better sellable and credible candidate to helep unu redeem unu name for Sapele and bring good development to the grassroot level,with vibrant and aggressive change. To unu wen be the Aspirants for Chairmanship position make unu dey fly win,Kola and envelopes for air na unu own be that. No Oga fit impose e candidate on us for dis forum unless say we certify the person well and dash am pass mark. Ejaife you don fail go complete your Hotel wey dey opposite AT&P make we focus on Hotel big time. I REMAIN THE OTOTA1 OF SAPELE. THE URHUKPE1 OF OKPE KINGDOM. THE ASAMAIGOR1 OF ITSEKIRI KINGDOM. THE EAGLE EYES OF DELTA STATE. God Bless Sapele. SAPELE/DELTA STATE MUST BETTER.
Posted on: Wed, 28 May 2014 06:51:46 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015