SAPELE/DELTA STATE MUST BETTER. BEDC unu don dey make me dey - TopicsExpress



          

SAPELE/DELTA STATE MUST BETTER. BEDC unu don dey make me dey vex and na better trouble unu don dey find now as unu dey feel say unu go just dey do anyhow. Sapele people make unu see as dis BEDC dey oppress us for our right? Make unu know say dis unu company nor be solely Government get am again oh,becos as unu dey behave now,the tin dey irritate some of us for the Town badaly. I know say unu don dey improve the supply system of the light,as Amukpe feeder don dey enjoy constant supply of light. When i carry out my research i cum see say unu throway unu resources for Amukpe feeder becos of Eternit Nig Ltd,wey dey behind dat area as dem don fully return back to deir own feeder. I congratulate unu and i also see am say nor be every where for the Amukpe dey enjoy dis lite supply,becos some areas Transformers nor dey good. I hereby put am to unu say na unu responsibilities to fix up those Transformers becos e dey among the the things wey unu buy,either as an Asset or Liability,so unu suppose add am to unu budget to replace the failed ones within the Town. Some areas nor dey get dis Lite well,yet unu don distribute Bills follow them. Unu suppose know say na wetin person collect,buy or receive e dey pay put. Unu nor go fit expect some few people within the Amukpe feeders to enjoy the lite and unu go still collect equal money from all d consumers wey dey under the feeder line. Dat one na stealing by trick. I hereby put am to unu say,make unu buy and distribute good Transformers within the areas wey nor dey enjoy dis lite,so that unu nor go get problems with consumers. Also i hereby request for PREPAID METER within the Town,so that we go know wetin we dey consume. If we look the other side of the Town wey Ogorode Feeder dey supply light,we go see say na Rationing nai unu dey do and initially na 4Hours On and 4Hours Off. But with the way and manner unu dey now,we nor cum dey understand how unu dey share the lite. This unu method of sharing light,atleast e be dey o.k becos e dey make us dey prepare ourselves dey wait for the light,and it dey enable us to manage the light well. But how long we wan rely on dis method of sharing of light? Na dsame Sapele wey we all dey nai one side dey get constant light and the other side dey suffer for darkness. Dis tin dey very bad becos i call am Electricity Slavery. I don dey try reach unu for Phones to get reply,but na to No Avail. Within dis Ogorode Feeder,we get some areas wey norva see light for days,weeks and months,wetin be unu efforts to repair dis faults,so that the consumers go enjoy deir Right of electricity. BEDC dis Ogorode Feeder nai dey supply the most populated side of Sapele,and the most Industialize part of Sapele. With d issue of light sharing,the tin dey disturb so many Businesses and some petty business wey rely on light,don close down due inconsistency of the light. I nor go only see the bad side of BEDC make i nor appreciate the good side. Becos since unu take over this company electricity supply don dey improve. I nor dey make dis post to insight quarrel between those wey dey enjoy the light and those wey nor dey enjoy am oh,but na for the company to improve on their services,becos Electricity na one major thing wey dey enforce development within our locality. BEDC i know say e nor easy,but i dey call on the Authorities to understand say the Poles,Transformers,Wires and other materials wey dey helep unu dey supply Electricity to consumers well,say na unu property,therefore make e end today say one tin go get fault,then unu field workers and unu Unit Managers go dey collect money from consumers to buy materials. This act na very serious rubbish wey go make us frown against unu,becos we nor fit dey pay Bill,dey buy materials for unu. From my Studio wey dey Okpe Hall,i hereby call on all authorities involve on dis light issue to call the Sapele BEDC manager to order becos enough is enough. Make i go Malaysia go helep dem find the missing Plane for India Ocean,as a good citizen of the world. How Plane go lost for 8days? I remain the Otota1 of Sapele. The Urhukpe1 of Okpe Kingdom. The Asamaigor1 of Itsekiri Kingdom. The Eagle Eyes Of Delta State. My people dis light issue must Improve,abi i lie? SAPELE/DELTA STATE MUST BETTER.
Posted on: Sat, 15 Mar 2014 06:09:19 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015