SAPELE/DELTA STATE MUST BETTER. Chief Lucky Ayomanor DLA Vice - TopicsExpress



          

SAPELE/DELTA STATE MUST BETTER. Chief Lucky Ayomanor DLA Vice Chairman DELTA STATE. Na small small craze dey start. I don talk am before and by the grace of God i nor go fear you to stop d truth even if u pronounce 7minutes for me,wey i know say very soon dem go even suspend you from our church becos u nor get contribution. You wey be son of the soil with vibrant strenght from opposition party,cum claim DLA Vice Chairman position for State after u decamp enter PDP. If person nor protect e eyes dirty must fly enter. The oregerege wey u start so,u must end am oh. I go dey wonder the kind mind wey unu wey be Sapele children get. Weda dem cement unu heart i nor know. When i dey praise you then say u dey try,i think say u rili dey work with ur upstairs but as time come dey go,all d issues wey i spot out for you during ur fake repairs don begin dey expose deirselves one after the other. You go carry project from State Government,say u wan repair roads and when dem give you na fake materials you go open ur own eyes take do road wey concern ur locality. If i naked swear for you dis morning,e go affect you. Athink when Hon. Monday Igbuya do roads with fake material,u go dey laugh like say na you better pass,unknowing say na u worst pass. Name all the roads wey DLA repair under ur office?All of dem don spoil back and na everyday dem tear dey open mouth. *Na Commercial Avenue? *Na Owumi Road? *Na Abeke Rd? *Na Ajogodo junction? *Na Gana Road? *Na Commercial Avenue by Adeola Rd? etc You just sidon begin use ur hand dey spoil your name after you start well. Na for phone i tell you say dis Adeola Rd by New Road wey u dey do so,say na fake materials dem dey use and say the work nor go last. You open ur gutter dey make mouth say u get standard Engineer and e know work. Nor be the road don spoil so? I fit count many people motors wey nor know dat route despite say dem dey mobile,yet u dey buga for Sapele dey go print BILL BOARD. I sorry for your full life becos your first One Million Naira wey u make from dis ur appointment na Chieftaincy title nai u use am chop,like say u get who dey pursue you for life. Report zoom enter my ear,say u wan contest for HOUSE OF ASSEMBLY. Nor mistake talk am again,make i hear you and if na becos of dat one nai make u dey print BILL BOARD just rest becos u be disgrace to Sapele soil. State give you money to do roads,u begin split the work,dey do half half so that u go see enough money chop. How on earth u go dey repair; Akpoisi Road. Adeola Rd by New Road and Ajimele Road once? Why u nor use d resources finish one first? You open ur eyes dey inflict pains on d masses and yet u still gada mind come out say u wan go HOUSE OF ASSEMBLY. Make i nor too talk make e nor be like say i dey lie. Sapele people the few Businesses wey dey Adeola Road by New Road don dey suffer big time due to d poor state of that route and our Delta State Vice Chairman nor know e self to helep repair the place. Abeg make unu see Road wey Chief Lucky Ayomanor chop money put and yet e still dey proud say e wan contest. Unu go dey bring shame to us for Sapele. Athink today and tomorrow na Late Patrick Aziza burial,wey big wings all over Nigeria go attend? Then dem go come pass this Amukpe and Adeola Road to see say unu nor dey try. If unu nor dey shame,we wey be the masses dey shame becos na our right to get good roads. I rest my case. Na Urhiapele Ameh go strike unu wey dey wish Sapele bad. I Remain The Otota1 Of Sapele. The Urhukpe1 Of Okpe Kingdom. The Asamaigor1 Of Itsekiri Kingdom. The Eagle Eyes Of Delta State. God Bless Sapele. My people d person wey do dis road like dis worth our vote? SAPELE/DELTA STATE MUST BETTER.
Posted on: Thu, 09 Oct 2014 07:40:00 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015