SAPELE/DELTA STATE MUST BETTER DRESS CODE Dem say na the way - TopicsExpress



          

SAPELE/DELTA STATE MUST BETTER DRESS CODE Dem say na the way you dress nai dem go take address you. Dem still say first impression matters a lot. No matter wetin you get for head, na your dressing dey first dey interpret who you be. E dey pain me say we dey over look the importance of good dressing for sapele. Nor be to wear expensive clothes or designers dress nai be good dressing. But na to dress according to occasion nai make you an expert in dressing. Dem say, wrapper wey dirty better pass the one wey burn. Na so e still be say, Trailer dear pass Honda Spirit, but you nor suppose drive am go party. Now, these na wetin I discover for this Sapele as I dey sweep the town every now and then to make sure say e clean. 1. Many mothers wey dey carry pikin go school go dey wear hair net come drop their pikin for school. As long as you wan commot from your house as a woman, know say you dey represent many pipo: yourself, your husband, your family and husband family, your working place, your business, even your children and your friends nai you dey respresent becos pipo dey see you. Some dey even dey wear nightie sef. Dem nor go wear bra inside o. Their slippers breasts go dey tempt pipo husband wey dey around. 2. Mothers and young girls wey their person dey hospital for admission. I beg, hospital and clinics na public places. Make unu dey dress well. Many of unu go dey tie dirty wrapper, wear only tight for small t shirt, and wear tear tear hair net. Please, make unu dey dress well dey go public places like banks, library, etc. 3. Dressing to traditional marriages and parties. Make I point am out to most Itsekiri and Okpe young guys and millionnaires for this town. When unu wan go person traditional marriage, make unu dey wear traditional clothes. Most of unu go starch trouser, starch packet shirt, starch T shirt, starch canvas too. Nai unu go wear go person traditional marriage or burial. Why? When unu dey see pipo wey wear clean traditional dress go traditional occasions, how unu dey feel? Make unu change o cos oyibo man nor say make we throway our culture becos of their own o. Then those work men like bricklayers, tilers, mechanics, etc. I beg unu with the biar biar wey dey Pete Edochie face, if unu dey go work, make unu dey wear clean clothes becos unu nor be craze. If unu reach unu working place, make unu change to work clothes. But if unu wan go outside work, pull that working clothes for tools bag, where clean clothes go there before you change. Why I say this na becos of one man wey army beat for skye bank for Benin say the man na craze. But when the man gain balance, e come say e be mechanic. Say, him client, one cashier for the bank nai call am make e come carry e car go for servicing. Becos of e dirty coverall, army think say na ment. If you wan go inter house sports or any sporting event, dress in sport wears or casuals like jeans and T shirt and canvas or All stars or crips. If you wan go wedding and you nor sew aso ebi or join family, you fit wear clean english attire. This na wrong dress codes: 1. Black belt for white or brown shoes. 2. Sandals for suit. 3. Tuck in for sandals. 4. Tuck in t shirt for trousers. 5. Fold longsleeves hand and you tuck in. 6. Wear tight t shirt wey dey show your pot belle. 7. Wear dark sun shades inside church or hall or house. 8. Wear suit and you nor tuck in your inside shirt. 9. Girls wey dey wear shirt wey nor dey cover their yansh and dem wear tight. 10. Wearing bathroom slippers from house. 11. Wearing tie for double pocket long sleeves and flower shirts. 12. Folding the hands of your suit. 13. Sagging your trousers or nika. 14. Wearing shorts or nika to public places like banks, church, mosques, etc. 15. Woman wearing short nika from her house dey bad. This one don dey turn fashion. 16. Not wearing wrist watch na bad dressing o. 17. Wearing colour riot. Dem many o. We fit add our own. Many pipo nor really know how to dress well but if we dey close to such pipo, we fit dey correct dem. Wetin dem dey wear go night club, you nor go fit wear am go church o. So, dress according to your occasion. And when we see person wey dey dress any how, make we correct am with love. E fit nor know better. Indecent dressing get causes o. But I nor wan go too far cos this post don dey long. Parents, friends and clothes sellers dey contribute to wetin dey make pipo dey dress anyhow. Make we dey dress well my pipo becos na we use our mind take decide say we wan wear clothes. Suppose Adam and Eve nor eat apple, we for nor dey talk of indecent dressing but na indecent sampling nai we for dey discuss. God Bless Sapele. SAPELE/DELTA STATE MUST BETTER
Posted on: Fri, 21 Mar 2014 14:22:54 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015