SAPELE/DELTA STATE MUST BETTER. Hon. Monday Igbuya. Hon. - TopicsExpress



          

SAPELE/DELTA STATE MUST BETTER. Hon. Monday Igbuya. Hon. Paulinus Akpeki. Hon. Austine Ayemidejor. Hon. Julius Egbedi. Hon. Godwin Atose. Hon. Felix Anirah. Hon. Micheal Diden. Hon. Henry Ofa. Hon. Evelyn Ojakovo. Senator Edesiri (Dem norva swear you in). Make unu get up from unu bed,make unu look unu self for Mirror well and make unu ask unu selves say waiting be unu impact for Sapele as Leaders? I Chief Okpubuluku dey vex for all of unu,becos as unu claim say unu strong reach for Delta State Politics,unu nor qualify to represent Sapele for Delta and National level. I know say many pipo go surprise say i vex dis morning,as i list all unu names and command unu to look unu selves for mirror dis morning. Na from here wen we dey nai i dey shout since say Amukpe Roundabout na Death trap. Unu quiet. I even go far to call all unu about dis issue of Amukpe Roundabout wen unu Govt do wen big lie fool,yet people dey die dere anyhow,as the Road signs nor dey effective,also the speed control pattern too close to the Roundabout,to d extent say Big Lorries wen dey pass dere,mostly for Night nor dey quik notice the Roundabout before dem tap break. Before the inception of Federal Road Safety Commission for Sapele till date,we don record up to 21 people wen don die for that Roundabout. And yet unu norva find any lasting solution to the place. The last time wen one Lorry fall for inside the Roundabout wen d Driver take die flat,na around 5a.m nai dem call Hon. Julius Egbedi commot from bed and e quik report to d scene. I mudiaga near am wen e dey complain about the place. E nor tale nai i call am,to discuss our we go use take find solution to the Roundabout,but e nor talk wetin sweet my ear. I also call Hon. Monday Igbuya,but becos of airtime wen i nor too get that time,me and am nor too talk. When i manage go carry wood for sawmill take buy recharge card,e number nor go again,so i cum call Hon. Austine Ayemidejor, d reason wey make me like dis man small be say e sound educationally,but e nor dey serious wit e words,becos after we talk on how we go write the Ministry Of Work and also Road and Transport and also e promise to meet wit all PDP Stakeholders to see as dem go put heads together to write to Asaba,so dat if Abuja approve,so dat State Govt go carry out the Re-construction of the Roundabout. Up till now Nobody don do any meaningful thing to helep us wen dey Sapele to fight dat Death Trap. Barely 4days back nai our Governor announce and approve Fly-Over Bridge for Effurun and Asaba. Wen i carry out proper investigation. How? Why? And When e announce am,i cum see say na becos of the Traffic wen Effurun Roundabout dey experience nai make am award the contract. Na dere i for ask myself say how many persons don die for Effurun Roundabout and Asaba Wen dem one put Fly-over? Federal Road Safety Commission na unu dey go pik and deposit corpes for Mortuary. Who unu dey give unu reports to self? Becos for advance nation,if one particular spot dey kill pipo,dem must find a lasting solution to that effect and death rate go cum reduce,as na solutions nai be deir problem. I nor wan talk too much or insult unu wen be Political Leaders for Sapele,as i line unu names for the starting of the Article na so unu educational certificate dey useless,as unu nor fit put wetin unu go learn from School into practice. I wonder how long we go dey for Sapele,wen this Government go just neglet us,like say we nor dey the Delta State. In the midst of Scholars like Hon. Austine Ayemidejor wen suppose fit convince our State Governor to do something,unu just keep quiet and i tell unu say na bad representation nai unu dey give us. As at wen we dey compile dis Article somebody say if unu oppose the Government,say the Man wen dey ontop nor go support unu again. Dat na lie,becos who dey do well na from House dem dey pray for am and nobody get right to sack God pikin. Make unu know say nor be only poor people dey pass dat place and anytin fit happen to anybody at any time. On a normal day as FRSC dey report death from dat spot,if unu really get Sapele for heart,unu suppose take am like unu problem. Dis one wen i just range unu so,na make unu for know say as unu many reach,unu norva fit do any meaningful thing for Sapele and its environs. See, *Songhaii and *AT&P. Employment for Sapele na Zero. Wen i ask unu about employment,unu go say unu don empower many people for the Government,like say nor be deir RIGHT to get Government work. As i dey see unu so,make unu go tell Oga Governor say Sapele nor dey Edo State oh,say make e add Sapele Roundabout join the place wen dem wan put the State Fly-Overs so dat Death rate on accident for Sapele go reduce. Na message nai i send unu,if unu like make unu nor act,but wen e go happen to any of unu,na me go first alert the World say dat Roundabout wen i call Death Trap,don finally kill one leader. My dear Safarians dis thing wen dis Government dey do us so, e good? THE OTOTA1 OF SAPELE. THE URHUKPE OF OKPE KINGDOM. THE EAGLE EYES OF DELTA STATE. SAPELE/DELTA STATE MUST BETTER.
Posted on: Thu, 24 Oct 2013 05:23:37 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015