SAPELE/DELTA STATE MUST BETTER I know say, this update go make - TopicsExpress



          

SAPELE/DELTA STATE MUST BETTER I know say, this update go make many pipo gentle. Me, whether unu like am o, or unu nor comment o, I go write wetin dey my mind like woman wey wan born. I go pour everything out wey concern us for this matter. Who nor like am, make e go buy cement take cement sapele Local Government Secretariat. Period. TO THE LADIES I don waka all the churches wey dey dis town finish and I don observe all their programs. I discover say, na women dey attend church programs pass. Unu know the major thing wey dem dey go tell pastors make dem pray for? 1. Make so so so man gree marry dem. And in most cases, that man go get one better babe wey dem don dey tay together. 2. Make dem pray so that another babe for outside nor go take their husband or turn am to sugar daddy. 3. Make their husband for dey love dem well like befor since may be, na so so fight dem dey fight and many times, the husband nor dey sleep house again. Na just this question I wan ask unu wey be women. 1. The man wey you dey marry so. Wey dey make you dey waka church up and down say becos e dey friend one babe. Na you nai disvirgin the man? If you good well well, the person wey you disvirgin nai for marry you. Abi you nor know say woman dey disvirgin man? 2. Na the man nai disvirgin you? 3. The man dey friend babe befor you marry am? 4. Na you the man first promise marriage to? Nor answer the questions for paper o. Write am for your mind. I dey come. TO THE GUYS When unu don gather for drinking joints, na so so rubbish unu dey discuss becos na only few men dey devote their time dey stay church with christian heart. Hear wetin most agbalagba dey talk about for beer parlour. 1. How dem take straff babe. 2. How babe kpoyon be. How her breasts small or big and how her yansh be like nai big men go dey talk. 3. How dem take doke babe, babe mama, babe friend and even babe sister join thinking say dem be striker nai dem dey discuss. Unu wey dey do this things, unu nor get sense o. And most times, unu go get problem with unu real babe or wife, unu go drive her. Now answer this questions make you subject the answer for Abacha grave. 1. Na you disvirgin your partner? 2. You nor snatch your partner from somebody? 3. You nor dey cheat on your partner? Now, if you as a man dey cheat on your partner, and your partner come mistakenly cheat on you, why you go say make she pack? Na you better pass? Abi why unu dey feel say that male chauvinism go lead us to any good place? If you wan straff another woman join your partner, go pay her dowry make you get license to kill. Sorry, to straff. Make we stop to dey pray die die prayer or plan to kill those wey dey cause our marital woes becos we don still be problems to pipo befor. So, wetin I get to advice be this, Prevention is better than cure. 1. If babe get serious guy, I beg, give her chance. Nor spin her. 2. Concentrate on one man one vote. If you must vote twice, legalise am. 3. Nor date married man becos somebody or pipo go surely date your husband when you don marry. 4. Nor divorce your partner becos of any reason becos nor be you holy pass. 5. Nor date more than one man at a time becos when you nor marry one, na enemy you don give yourself. 6. Nor promise woman wey you know say you nor go fit marry marriage just becos you wan straff. Many men don pass there enter their duplex for hell fire. 7. Nor scatter person with e partner with prayers make you for marry am. You go succeed but you nor go get peace. 8. When you nor like person reach to marry am, nor give am hope just becos you wan to dey doke or chop e money. Just tell am straight make unu part jejely befor e too late. 9. Nor use quarrel or misunderstanding take leave person wey don try for you. If you don taya for any relationship, nor start to dey misbehave make d person for drive you. Tell your partner peacefully and pray fervently for Gods intervention. 10. Try to be faithful for any relationship you dey keep. Two timing nor be smartness. Na foolishness. I know say this water wey I turn for head so go touch prick and brokos. Carry towel make you clean your life. I dey go buy g string for my Alsatian dog. God Bless Sapele. SAPELE/DELTA STATE MUST BETTER.
Posted on: Sat, 03 May 2014 13:56:33 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015