SAPELE/DELTA STATE MUST BETTER. Na from small pikin dem dey - TopicsExpress



          

SAPELE/DELTA STATE MUST BETTER. Na from small pikin dem dey learn how to waka,talk and run,nor be for old age. Who know say e get bad intention for Sapele and Delta State as at against 2015 Election,na God go helep us fight against that person or group of persons. Report don blow enter our studio say APC Political Party wen just happen to dey among the strong and reliable Political Parties,don dey shake anyhow for Sapele,which means APC for d State might nor fit produce meaningful challenge wen go bring about positive competition to produce good Governance wen go bring sanity to Sapele and Delta State. Make I quickly highlight the small issue wen dey disturb dis Party,becos for National issues,dem dey do Party members registrations. Dis simple registrations don dey expose the greed of the Party members within Delta State and Sapele in particular. APC for Sapele get two factions,one na dose pipo wey leave DPP with late senator Pius Ewerido and na Cyril Ogodo,Chief Okobia and Chief ABC dey lead dem,dat group get weight well well bcos na Otega Omero nai dey sponsor dem. The oda one na the three legacy parties (ANPP,CPC and CAN) nai merge togeda form am,and na that welders association of Sapele chairman wey dem dey call Peter Oromayene and Engr Elvis Ayomanor nai be dier leaders.Even though na Peter Oromayene nai be dier chairman,but e be like say na Engr Elvis Ayomanor nai really get control of the group. Now APC dey do membership registration and each side dey register dier own pipo and Chief Ede dafinone don decamp come APC,Ede now don confuse of which faction to join. Now Cyril dey lobby Ede Dafinone to join him side and Elvis and Peter Oromayene dey lobby Ede Dafinone to join dier side,Report reach us say cyril meet dem Oromayene and Elvis for Ede Dafinone house about four days ago and Oromayene com dey insult Cyril,he even dey tell Ede Dafinone say make he nor work with Cyril say Cyril nai betray Ede for last senate election nai make late Pius Ewerido win am.As it is na e be like say Ede wan sitdown for top of the fence dey watch dem,and na 22nd of dis month them wan do dier ward congress and the LGA congress na 28th of dis month.I think Ede wan pinch him tent with any of the group wey go win this fight and me too I sitdown for the fense with Ede Dafinone dey watch the fight and as I dey see am so, dis power tussle between Cyril Ogodo,Chief Okobia,ABC chemist and dem Peter Oromayene/ Engr. Elvis Ayomanor nai go finally tear the party and give PDP the victory in a plata of gold if dem nor wise resolve dis dier dispute,bcos I hear say the two groups don vow to fight each oda to quench. How we expect foundation wey nor strong to produce vision leader to contest dis 2015 with big PDP wen nor dey ready to loose dis Oil Producing State to any Political Party wen nor ready well for better fight. Now make I warn all unu wen PDP send go APC go cos problem to dey very careful,becos na Prayers nai we go use burn all unu,as unu nor wan give space for constructive Politiking,wen go make us produce a better and quality leader wen go ready to work out development and take us to our promise land. Today I dey use dis update,dey call on the State APC to restructure deir Excos becos wit d likes of Chief Okobia and Chief ABC and others,I nor see the creative and modern team wey go fit stand challenges. Also I believe say wit dis crops of individuals,we nor get better hope for the change wen we dey clamour for comes 2015. So unu must understand say d key to success now relies in the hands of the Youths. So I urge unu to change unu cabinets and fill in the space with reasonable young minds to compete wit the lions wen dey power,if dem go fit win dem,becos I believe say even PDP dey struggle right now to produce a very sound candidate for Gubernatorial position,and other positios. My great Sapele and Deltans and friends of dis page. Wit the way and manner of Sapele APC,unu think say,dem ready to fight successful fight or na still anoda unprepared DPP wen nor fit hold deir ground? Becos as far as I dey concern dis conflict na stepping stones of failure. Na me Otota1 of Sapele. The Urhukpe1 of Okpe Kingdom. The Eagle Eyes Of Delta State. Make we nor throw stones to eachother on dis topic,becos our insults don dey too much on eachothers,and we dey forget say,some persons na our seniors and I don also realise say,e dey deprive some commentators not to talk. Therefore I nor go condole any further insult from anybody,as na shap unfriending nai go await anybody wen use bad language against anybody. Make we try to dey appreciate eachother opinions. Wetin be ur advice to APC for Delta State? SAPELE/DELTA STATE MUST BETTER.
Posted on: Thu, 13 Feb 2014 05:49:30 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015