SAPELE/DELTA STATE MUST BETTER PLAY TIME. PURE WATER - TopicsExpress



          

SAPELE/DELTA STATE MUST BETTER PLAY TIME. PURE WATER COMPANIES FOR SAPELE Make we take our minds back to those years when we dey hawk ice water for Sapele. Na rubber bucket wey get cover nai we dey put the ice water. We go come dey use rubber cup take dey sell for person to drink. One cup na 50 kobo. Then, we come open eye start to pour the ice water for Cellophane dey sell for #1 too. All this while we dey enjoy the water o. No typhoid, no cholera. But now, we come enter sachet water wey dem dey sell for #5 and bottled water come escort am come too for #50 and #100. My pipo, for unu mind, how many pure water company dey sapele? Oya, make we start to mention their names one by one. As for me, I know of Moovig water. Nai me dey use take dey flush toilet and wash clothes. Na River Ethiope water I dey drink. Spirit nor dey fear die. If you mitate me, cholera go take you play tennis. Lolz. Which water for Sapele you like pass? God Bless Sapele. SAPELE/DELTA STATE MUST BETTER.
Posted on: Thu, 01 May 2014 18:17:18 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015