SAPELE/DELTA STATE MUST BETTER. SAVE FOR THE FUTURE. Oyibo - TopicsExpress



          

SAPELE/DELTA STATE MUST BETTER. SAVE FOR THE FUTURE. Oyibo say stone wey dey roll nor dey gather mosso. River wey dey flow dey always dey clean dat na must. So, in life, when we dey move positively, we nor go gather rubbish and we go always look clean. Rome dem talk, dem nor build am for one day. Little drops of water make a mighty sea. If you dey piss for one place nai e dey foam. Na wetin you keep nai you dey go take. My pipo, who get ear make e ear. Dem nor dey use big teeth take dey be dragon. Life na wisdom. SAVINGS : Savings na the small small way of keeping some part of your income for a place for future use. The rate at which many sapele boys and girls dey spend money, e dey make me dey wonder. Na better thing dem dey immitate. HOW DO WE SAVE? Na different ways dem dey take dey save money. 1- Save for Bank. If you nor get account before, try go open account for any bank. 2. Dey do collector or Osusu every day or every week or every month depending on how your money take dey come. 3. Do iron or wooden safe wey nor get key, put am for house. As money dey come, dey put small small for inside the safe. Now, before you go say you want to save money, you must sidon think first. Ask yourself the following questions becos nai go guide you in saving well. 1. Why you wan save? 2. How much you want to save wey go reach you do wetin you plan to do? 3. How much time you go take save am to make sure say the money correct? How much you go dey save everyday, every week or every month. When you don calculate this, you go come kneel down pray to God make e give you the grace to realise your dream. Dem nor dey use power dey stand prick . If God nor dey your plan, nai be say you don plan to fail be that. As you start to dey save money so, you go make sure say you reduce some unnecessary expenses wey you dey do like; - clubbing - partying - womanising - smoking and drinking - buying of unwanted expensive clothes and shoes. - unneccessary hotelling and travelling with babes. Etc We know say e nor easy to stop all these things, but when you get plan to do better thing for your life, you suppose to dey determine to throway all things wey go make you nor achieve am. Now, ask yourself this thing; -pipo wey dey build house so, dem get two heads? - pipo wey dey buy cars, dey marry wife, dey train children for school, dey travel abroad so, na all of dem do blood money? No. Many of dem plan their life well. Dem save well. And God come give dem the grace to realise their dreams. So, you fit start from where you dey now. You fit dey inside club, hotel, party, meeting, house, church, mosque, motor or you fit even dey bed dey read dis update. Please, if e good for you today, Sapele go better tomorrow. Make we take life serious. So, decide to have a goal, a plan and save towards it. E nor mean say we all must build house buy motor. But e good say we all suppose to live well. E dey pain me say some Girls for this town, na ikenekpe house (mud house) nai dem dey stay with their poor parents, but dem dey buy and sew brazillian hair, buy and wear designer clothes. E nor bad to buy dear things, but make we dey do the important things first for life. Save your money make you use am take upgrade your life first. Sometimes, some pipo dey give person or their friends money to save for dem. My pipo, if you dey do am, I beg go collect your money from dat friend hand. I nor want make e be say money nai make your best friend be your enemy. Nor save money for friend hand. Even collector sef, nor do am for your friend hand. Story nor dey commot. Savings good wella. For every N500 you make, keep N50. For every N1000 you make, save N100. E small if you look am like that. But if you dey save am without fail, before long time, you don save better money wey you fit use take; -pay your school fees, buy land, buy motor, travel abroad, pay house rent, etc. As human beings, e good make we enjoy ourself but e good make we use our sense. Expensive phones nor be priority. Drinking anyhow nor be priority. Smoking nor be priority and the unwise spending for ashewo wey nor be your wife or babe nor good. Make we reduce our expenses so that we fit save well. I love to see young pipo dey marry, raise good family. I want to see young men and women wey dey work get house of their own. I want to see young hustlers dey rent good house and furnish am well. I want to see young business guys dey drive good cars. Nor be say we go dey shout say who build house buy motor and marry na ritualist becos of the way e take do things. My pipo, na sense o. make we dey save. As for me and my crew, dis year, we wan open our DSTV Station for Pontu. So, we don dey work and save towards that. God bless Sapele. SAPELE/DELTA STATE MUST BETTER.
Posted on: Wed, 29 Jan 2014 14:15:10 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015