SAPELE RADIO @ THE HOUR. 24/10/2014. Report enter studio say - TopicsExpress



          

SAPELE RADIO @ THE HOUR. 24/10/2014. Report enter studio say one serious accident victim wey dem rush enter General Hospital,after about 3 Hosptals don reject the victim. When we reach there,we come find out say the victim na very old man and na serious deep cut e get for left leg. As at wen our team reach dere,the useless Medical Doctors wey dey on duty nor even dey reason d man and d man dey ground dey die. The ekpalacious Doctor wey be like who nor get Papa dey dere,dey ask of Card and Part payment. Na anger i use commot. Report reach us say almost all the footballers wey dey Sapele assemble dis morning as dem carry GREAT OMAMIE relics dey waka round Sapele environs. Them branch Sapele Stadium do a minute silent and prayer for am. All them Ike Ibe,Ochuf,Eric Jenije, etc. Others wey dey the line na Awo,Precious and all Female Lonestar Girls and Football lovers. We wish Omamie rest In Peace. Report enter studio say that Sapele boy wey die for Agbigborodo community clash between Ayiri 911 resource group and the community people,due to power tussle. After the Family don keeo the poor boy corpse for mortuary dey fine financial settlement,na today dem come pick to do the boy burial. Them don move the boy corpse go Koko go bury why them gada dey wait dem wen go Koko for Kingstreet near that HOME BOYZ Night Club,wey dey off Urhobo Road. Report enter studio say Omare Beer store for Laboard Rd by Yoruba Rd, dey catch fire sience yesterday,and dem don dey give wrong accusations, d two girls wen carry dis matter 4 head na dem own worst pass. One na Happy be her name wey get skin disease for one part of her face, dis one na slaughter men she dey deal wit she nor dey rest, her boyfriend na Oghale,wen dey stay Urban Area and he dey carry wood for Palmer Rd,she dey use d guy head take dey wash her transformer, she go dey tell d guy say she nor want again, at d end she go pass back go dey beg Oghale. Also Marian and nor be her real name be that, na she dey form saint for dat Omare store pass, but she dey wire lyk witch & na her madam houx she dey stay, if she wan remove go poke, she go say She wan go plate her hair, na hair she go plate oh till her seniors, go open store she neva still cum back & wen she go cum she go cum dey beg make dem for nor yawa her and dem nor dey fit dey send her message her salary na just 8k per month, but yet na xo so ATM we for dey see her for Court Road, if u demand for her number she go do lyk say she nor wan giv u! But later she go write am 4 piece of paper cum and also she dey whatapp lyk devil, u fit kill her wt whatapp she nor sabi calculate make dem still teach her how to calculate , na only she dey sell leave money for customers, abeg try go ur School well oh Marian na so she stubborn lyk who Ogbanje sprit dey follow. All those Omare Girls wen don work there b4 all diz new ones years back dem don go,but yet dem nor fit stay for their houx or neither their store, their names na Eloh and Bridget na xo dem dey disturb customers wit ragging of money and drink and still on programming, bridget pikin dey waka follow every were 4 d store she cum old once n sum of diz girls na xo so judge dem dey judge. Deir crew names; Happy, Eloh, Marian I tire 4 diz set of girls na so dem go dey rush food dey get each other grudge. Make unu allow us dey enjoy our beer in peace nor be d won wen Eloh and marian dey do coni coni business dey sell madam things more dan d price wen dem put. All dis girls get criminal heart. I DEY STILL DEY COME FOR UNU. Report reach us for studio say one woman wey dey drag Igbo badaly,as ARMY cramp her for New Road by Old Ministry junction near DEAR MAMA LAUNDRY. The process wey Army dey drag the woman enter deir Hilux,na dere the woman for begin rough the Army guy uniform. Wen dem finally drag the woman enter the Hilux,she come jump window come outside,na dere the Army guy wey dem dey call SANI cum crack gun,say he wan shoot the woman,nai one guy jump come out begin beg the Army,na dere nai the Army dem use d guy shine. Then brush 4years commot from the guy body until dem cum toll d woman enter their motor carry her go with force. As them dey go dem cum warn say dem dey come back to the area to come raid the Igboo compound. If Army nor know the place,make unu know say i know the place becos unu dey use Poultry dey cover face for that fenced compound and na strong Igboo joint. Report enter studio dis early morning as Tafia Elengoro dey waka along Benin Road dis early morning. Nai e see one mad man for Urhiapele Secondary School area,for one bad corner,e dey hide,dey make calls, e wear one white shirt and torn Boxer. The guy wey dey impersonate Kolo so get long bears,and na Nokia Fone. I dey use dis update dey call on relevant authorities to check mate dis guy very fast. Report enter studio dis early morning by 3am. As one of our industrious son die of cardiac arrest,and him na d eldest son of Late Chief Daniel Oyibo Oghene. This e eldest son attend Urhobo College Warri, he drop at the age of 67 years and e name na Peter Oghene. We pray make God accept him soul in Jesus Name. Amen God Bless Sapele. SAPELE/DELTA STATE MUST BETTER.
Posted on: Fri, 24 Oct 2014 12:38:14 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015