SATURDAY 27TH AUCHIPOLY NEWS LIVE: UNA GOOD MORNING - TopicsExpress



          

SATURDAY 27TH AUCHIPOLY NEWS LIVE: UNA GOOD MORNING OOOO.......... Report reach us yesterday say SPAT exam timetable don fall out but wen we go confirm we come find out say na only Mass com and bus admin nai dem don release, we come follow mallam oseni talk yesterday wen be Accountancy PC he come say na today dem go release Accountancy own and many more departments so make una cool una temper small and wait for una own oooo............... Report still reach us yesterday say ND admission 2nd batch go come out latest before october ending and all those wen get long leg don dey stretch am now ooooo............... Regarding this HND exam timetable wen dem suppose release this weekend we try to reach some of the top official make we know waiting dey happen but all to no avail, but make we still wait today whether dem go release the timetable becos I know say the HND exam must be tuesday to thursday next week.................. Report reach us yesterday say delta state don ready to distribute another bursary to students and dis one na 19,500 if u get jamb reg and u come from delta make u go pay 300 naira to Zenith Bank on monday as e go soon expire oooo and na january dem go take pay the money ooooo................ Wen our news crew stroll enter school hostel yesterday we come find out say d place don dey turn grave yard small small. As na only SUG villa nai still get small life, even mama rashida no cook yesterday, abeg dey cook ooooo, becos spat students go still eat ooooo................ Report reach us say blocking don start for many department especially school of business make we still alert una say as una start na so we go start too oooo, we go make sure say we expose any lecturer wen we get him report here or find out.............. Report reach us yesterday say one motor almost run enter students wen dey cross for hostel gate but Thank God say nothing happen, abeg we dey call on mama rector make she help put speed breaker for that road as he go reduce car speed and help to save lives ooooo.............. This na wetin somebody send come our inbox yesterday....... Na landlady wahala o,23/09/14 she carry heavy armed SARS men come carry poor students as early as 4:05 pm carry dem go uzairu jettu police station for investigation on say the students dey threatened her life/steal her documents/ drink her minerals way dey for fridge, watyn funny me pass be say na 4months ago this thing happened o,see were devil dey use him demon hmm lest Dan 10 days to exam o,but thank God for some people way come from owan,warri,ekpoma,abuja and Buchi from ap SUG before them leave this poor students way na school dem parent send them come o,I want make huna touch light this mata well well,for students safety from wrath of this landlady make student no dey go that house go rent again............ Report reach us say MTN distribute some gift items give students yesterday for new Auditorium as dem dey do promo, dem give out Generator and frizer to the people wen win the dancing competition, hmmmmm Auchipoly I think una say Spat students no get use, why una come dey use us dey take dey make money, I go handle una very soon for this issue................. Report reach us from Engineering department say one class rep carry money run for spat e name na Endurance for NDF A if anybody know e where about make he inbox us oooooo................ This na waiting somebody send for our inbox yesterday........ U do well 4 dis opportunity wen u giv me. Wettin I wan talk nai b say make sch screen many of our lecturer bcus many lecturer nor know wettin dem dey teach. Dem go just cum class dey read textbook. Thou say lecturer wen sabi work dey o but d ones wen nor sabi work nai many pass. Na dere I talk am reach. I nor go mention deir names 4 security reasons. Dem many 4 ICT bcus na dere I 4 cum. I know say na so dem dey other department. Make management dey look d kind staff wen dem dey employ. And many lecturer wen dey cum 4rm other department cum dey teach borrowed course abeg make dem dey take d course serious bcus dey go just cum class cum dey do any how bcus dem knw say if we report dem 2 our HOD or DEAN, dem nor go fit do dem anytin bcus nor b under COMP SCI or ICT dem dey. Hmmm thank God say students dey see............... Report reach us say students don dey complain regarding dat ICE road wen dey under construction say e don too tail as na dey road nai link many banks and also campus 1 back gate, abeg make who dey in charge go do am ooooo bcos wen I pass there yesterday erosion don almost fall one caravan store due to the abandon work.................. Na here we go end our new today if you get any complain or u need our Assistant regarding anything make u let us know via our inbox oooooo............ AUCHIPOLY/EDO STATE MUST BETTER: NA ME TAFIA THE OTOTA OF AUCHIPOLY D OTARU OF AUCHIPOLY D ONOGIE OF AUCHIPOLY D EAGLE EYE OF AUCHIPOLY Nai dey give una dis news, abeg make I go admission office go see waiting dey happen for there, una bye bye...........
Posted on: Sat, 27 Sep 2014 06:58:28 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015