SATURDAY AUGUST 30TH, 2014. AUCHI POLY NEWS. Great Gbogbo, Great - TopicsExpress



          

SATURDAY AUGUST 30TH, 2014. AUCHI POLY NEWS. Great Gbogbo, Great Gbagba, Great Polytes, GOOD MORNING. som students Fb/Bbm Status As una read today NEWS beta tinz go day come una way. *NEW FACEBOOK GROUP@ AUCHI POLY GROUP CHAT #HND_Form_NOW_SELLING #CBT_Result_is_out #Regular_Exam_on_point 1. WORLD NEWS: Embassy oversee Pastor, Pastor Chris .O , Wife: Anita day file for Divorce. PDP VS APC: Ebola for Port hacourt. 2. SCAM ALERT: No Give your money to people way go help u do fake Admission. Be Wise!!! Beware of were you do your ONLINE REG. Because you Score Low for CBT Result, no mean say u no go get Admission, Be Patience!!! 3. SCHOOL NEWS: Accident shelle close to School Hostel Complex yestaday, Accordin2 Eyewitness, na Osas Motor Tire Burst cum go Hit Coca Cola Sign Board, we thank God, no lives wr lost, but the Driver Injure badly.. OMEGA FIRE Ministry, Jattu. Full yestaday as dem do deir Vigil Fire Night, way day happen every last Friday of d month. Abeg to all the Nigerian Students, Mak una Quick day Enta House for Night, Avoid things way go put you for Trouble. No go put Hand for Bad tinz, stay away from Trouble, so dat u no go Double Trouble. Campus1 Full yestaday with Students, lyk Say Na Party dem day do, But na Unto Next week Exam, mak them Gather for Prayer Section. Some People day Funny me, Na una day Anxiously day Wait for HND Form, HND form don cum from Liberia now, una day Ask wen e go Expire... Na dose way no wan buy day Ask Receipt wen dem buy Bread. Na joke i day ooo. Waytn dem need for HND Requirement, na all ur Credentialz way u use for ND, b4 you buy d Form, mak u Confirm, if d course way u wan offa day. NOTE; if you graduate wif Pass(2.49 below) for ND, na 2yrs u go stay for House. Aspirants way Apply for ND diz year, mak una take time oo shuwww la so una blood day hot?? ND Admission List go Ghana. Na Octoba him day cum bk. SES Students Pay ur SCH FEES to avoid storiez dat touchz... SPAT result day show face, smal smal for some dept. SPAT Form go Wedding for Kaduna , na Afta SES exam, Probably October Ending e day cum out. 4.ENTERTAINMENT: you get SHOW, EVENT way u wan Publicise, mak u inbox us. Today na Clubbing Nite for some HOTEL AND BAR. 5. ADVERT: Advertise your Product with us today, mak u Inbox us. If you Get Genuine Phones, Laptops, Home Appliance way u wan sale and Lodge for lease. mak you Inbox me also. DZICK art, way day front of Corporate worship day offer Cheap ART Work, if you wan do anytn lyk; Wedding/Birthday Cakes, Portrait Painting, Cards, Banners, Event Decoration,Sign Writin N many More.... MAk u Rush Visit him SHOP or Call 07064244307. Bold5, Nokia E71, Curve2 ,Curve7, Bold2 Ba3,Nokia C5, Nokia X2 dual sim for sale call 08101006164 6. SCHOOL INFO: *SUG NEWS: *AUCHI POLY EXAM: Regular Exam-School of Art&Design diz week, while the rest SCHOOL na next week. *SES Exam- September 29th *AUCHI POLY FORM: HND form don finally Come out. N10,700. HND CBT Exam na afta Regular Exam. SPAT form na October period. *AUCHI POLY ADMISSION LIST: ND/Bsc CBT result don Finally Come out. 7. SPECIAL SHOUT OUT: Wap Junior: day wish all d Students, Success N Distinction. 8. BIRTHDAY WISHES: If today na your Birthday HBD WULLNP. 9. HELP LINE: 08101006164 10. COMMENTARY: Abeg mak una they try they comment and share our post. Una Happy Weekend. 11. NEWS CIRCULATION: our News they reach 80,000 Students/Aspirants. 12. CONCLUSION: This na the news way we get for the day. Brought to you by #Wap_Junior For Complaint and Observation, abeg Inbox Me Personally.
Posted on: Sat, 30 Aug 2014 07:12:56 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015