SHOCKING NEWS!!! E DON BURST AGAIN. IF UR MIND NOR STRONG NOR - TopicsExpress



          

SHOCKING NEWS!!! E DON BURST AGAIN. IF UR MIND NOR STRONG NOR SCREW GO DOWN. . . . INTERNATIONAL GBWA.....1 . . . . INTERNATIONAL GBWA......2 . . . . INTERNATIONAL GBWA.......3 . . . . INTERNATIONAL GBWA.........4 . . . . INTERNATIONAL INTERPOL NAI ARREST.....! Na from small dem dey know who go better. E nor get as craze serious reach,e nor dey play wit Transformer. Na from small nai i know say dis Boy na big name. *Wen Okotie-Eboh dey reign for Buggy as Darlington dey dance dey win Babes from Chudes Girls Grammar School. Na dem Precious Izobo be d big Boys then. *Wen States dey organize Babagida must go den,na dem Precious Izobo nai lead the Riot for the Town wit matured minds. * Wen Inter-House Sport be like Christmas na dem Precious Izobo nai start to dey pin (Dress well) dey go toast babes. *Wen dem 606 Children dey oppress the town wit Pan 505. Na dem Precious Izobo dey order dem say. Wey U cum carry me go one Party. * Wen e mates dey use School dey proud. He record e name for Uniben. * Wen men use strong eyes for School take join Social Group base on hardship. E join and play d game reach ground before e grow white hair. * Wen U.k cum become Sapele priority. This guy blow guy enter London. * Wen men dey use kpeke as full time job. Precious Izobo ben Johnson dey go School. * Many men for U.k Papa die,dem nor fit cum,but dis guy dey travel U.k to Sapele like say na Uniben e dey go. * Dis guy nai single handedly Train e self from rough background and today e dey very successful for U.k. I stand on top Ewere pot dey sing HAPPY BIRTHDAY for you as u clock plus one today. I use Kpokpo garri take annoint dis ur fine red lips wit LONG LIFE as i use MAMA OGHALE Akpu take slap u wit PROSPERITY . Na the Kongo meat of OLD IYABO INN nai i take stone u wit FAVOUR and i send Amala and Ewedu soup of BREAKTHROUGH for you. I use the glass of SUCCESS take serve you MOET for Toast. Good HEALTH na ur portion. Death nor go near ur Family. I pronounce 7minutes to stupour you with GOODLUCK and DIVINE FAVOUR today as i throway heavy konk for ur head to make u get EXCEEDING GRACE wey go wire u to ur promise land of RICHES and Prosperity. Today i open my mouth tell u say u norva achieve 10% of wetin God get for you. All ur enemies no one go fat reach Fumilayo Treasure. I stand throway OTI PINNICK two small Seedy and Paul Asemota 2 seedy wey nor dey tire for plate as kola nut,and make e nor roll,i drop Kennedy Kalu (UK) Favour Omoraka (UK) Ajose Otomewo(UK) Aputintin Baba(UK) Tseye Amiwero(UK) Small Osaga wey dey form Bros and e nor get Chichi (UK) Odeyemi Odeleye (UK) Amos Dafinone (UK)Lucky Epor (UK) Emma Magoro (UK) Rotimi Odeleye ( Canada) Jnr Ese Gam wey dey quarrel wit e Papa (Canada) Victor Magoro ( Yankee) Taghene Ovwighose wey dupe Igbuya quietly take move (Canada) Kingsley Okoko (Yankee) Izerigbe Odebala (Yankee) Asura (Yankee) Old Sele Bonga (Spanish/ Abuja Burger) Sele cum back home. Odemi Sagay (UK/Sapele) Kingsley Jeremi (U no K/ Sapele Burger) Oyibo Ebosa ( PH/ Sapele Burger) Winor Kelvin ( Confused UK Burger) Darlo (UK) Tseti Bobi (SK) Efedenden (Lagos Burger) Payoyo (Yankee)Ogbe Pinnick (SA) and World Largest Kpakoto,the only Man wey dey use wrapper dey sow Boxers why e handky na Duvie and all ur friends wey dey all over the world take support the Kola. HAPPY BIRTHDAY to My junior for everytin PRECIOUS IZOBO. Make unu join me hala dis Borbor as the guy clock one today. MESSAGE COURTESY. Kizito,Jolomi and Amos Boyo.
Posted on: Sat, 12 Jul 2014 11:59:43 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015